Acts 3
3
Pita And John Heal Pesin Wey Cripple
1One day, Pita and John dey go di temple go pray for three oklok for aftanoon. 2Some pipol dey always karry one man, wey nor fit waka since en mama born am, kom di temple door-mot wey dem dey koll, “Beautiful Gate”, so dat e go dey beg for money from pipol, wey dey enter inside di temple. 3As di man si Pita and John wen dem won enter di temple, e kon dey beg dem for money, 4but dem look am strait for eye kon sey, “Make yu look us!” 5So di man wey nor fit waka kon look dem well-well, bikos e tink sey dem won gi-am money. 6Pita kon tell am, “I nor get silva or gold to give yu: but na wetin I get, I go give yu. With Jesus Christ name wey kom from Nazaret, stand up make yu bigin waka!” 7Pita hold di man for en rite hand kon drag am up and at wons, di man legs kon strong. 8Di man jump up bigin waka, e follow dem enter di temple dey waka, dey jump up-and-down, dey praiz God. 9Pipol si am dey waka dey praiz God 10and dem remember en face kon sey, dis na di man wey dey sidan for di temple door-mot dey beg money, before. Di pipol sopraiz well-well, bikos of wetin happen.
Pita Tok To Di Pipol
11Di man still dey jump follow Pita and John with happiness and di pipol still dey sopraiz. Den di pipol run go meet Pita and John for di place wey dem dey koll “Solomon Varanda.” 12Wen Pita si sey all di pipol gada, e kon start to dey prish, “Israel pipol, wetin make dis mirakle dey sopraiz una like dis? Why una dey look us like sey na with awa own pawa or holiness wi take make dis man waka? 13Na Abraham, Isaak, Jakob and awa grand-grand papa God, naim karry en savant Jesus Christ go up, di one wey una rijet kon gi-am to Pilate make e judge am, even wen e won free am. 14Una sey una nor wont Jesus Christ, di holy and Raitious Pesin, instead una sey make dem release anoda pesin wey dey kill pipol give una. 15Una kill di pesin wey dey give pipol life, but God raiz am from deat and wi bear witness sey dis na true. 16Dat Jesus Christ name wey wi bilive, naim make dis man wey una dey si and know well-well, strong. Yes! Naim name don heal dis man as una dey si so. 17So my brodas, I know sey una and una oga dem nor know wetin una do. 18God don tok before-before thru all en profet sey, di Mezaya go sofa and E don make am happen, thru wetin una do. 19So make una turn from sin kom meet God, make E for forgive una, 20so dat una go fit get freedom wey God dey give and E go send Jesus Christ, di Mezaya wey E don prepare down, kom meet una. 21Dis Jesus Christ go stay for heaven till di time wey God go make evritin betta again as E don tok thru en holy profets. 22Even Moses sef tok before sey, Jehovah wey bi una God go send one profet to una, just as E send mi and e go bi una family memba. Una must obey evritin wey e sey make una do. 23Anybody wey nor obey dat profet, dem go distroy am and dem go remove am from God family. 24God don tok about all dis tins wey dey happen so, from Profet Samuel time go rish di profets wey kom afta am. 25All of una get share for inside di promise wey God make with una grand-grand papa dem thru di profets. Na so E tell Abraham sey, ‘Na thru di pikin wey yu go born, naim I go take bless all di family wey dey di world.’ 26So God don raiz en savant and E don send am give una, make e for bless and help una turn from sin kom meet am.”
Currently Selected:
Acts 3: pcm
Qaqambisa
Share
Copy

Ufuna ukuba iimbalasane zakho zigcinwe kuzo zonke izixhobo zakho? Bhalisela okanye ngena
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee