YouVersion Logo
Search Icon

Matiu 9

9
Jesus Heal One Man Wey Paralaiz
1Jesus enter boat kon cross go en home-town for di oda side. 2Some pipol kon bring one man wey nor fit waka kom meet am. Wen Jesus si as dia faith strong rish, e kon tell di man wey nor fit waka, “My pikin, make yu nor fear! God don forgive yu all yor sins.”
3Den some law tishas kon dey tok to demsef sey, “Si as dis man dey shalenge God.”
4Wen Jesus know wetin dem dey tok, e kon ask dem, “Wetin make una dey tink dis kind bad tin for una mind? 5Wish one eazy pass to tok, ‘I forgive yu yor sins’ or ‘Stand up make yu waka?’ 6But make una know sey Man Pikin get pawa for dis world to forgive pipol dia sins.” So e kon tell di man wey nor fit waka, “Stand up, karry yor bed, make yu dey go yor house.” 7Den di man stand up kon waka go en house. 8Wen di pipol si wetin happen, fear katch dem well-well and dem kon bigin praiz God wey give dis kind pawa to human being.
Jesus Koll Matiu
9As Jesus komot from der, e si one man wey na name bi Matiu, wey sidan for where dem for dey pay tax. Jesus kon tell am, “Follow mi.” At wons, di man kon get up follow am.
10As Jesus dey chop for Matiu house, many tax kollectors and sinnas follow en and en disciples dey chop too. 11Wen di Farisee si wetin dey happen, dem kon bigin ask di disciples, “Wetin make una tisha dey follow tax kollectors and sinnas dey chop?”
12Wen Jesus hear wetin dem dey tok, e kon ansa dem, “Pesin wey well nor nid doctor to cure am, but na who nor well, nid am. 13Make una go learn wetin dis word mean: ‘Na mesi I wont, nor bi sakrifice, bikos na sinnas I kom save, nor bi good pipol.’ ”
New Tin Wey Betta
14John disciples kom meet Jesus kon ask am, “Why e bi sey wi and di Farisee pipol dey fast evritime and yor disciples nor dey fast?”
15Jesus ansa, “Pipol wey kom marriage nor fit mourn if di man wey dey marry dey with dem! Abi e dey happen like dat? But di day go kom wen dem go take di man wey dey marry komot from where dem dey, dat time, dem go fast.
16“Nobody dey take new klot pash di whole wey dey for old klot, bikos where dem pash for di old klot go tear more and di whole wey go dey der, go big pass di one wey dey before. 17Nobody go pour new wine inside old wine bag, bikos di bag go burst and di wine go pour trowey, den di wine bag go tear. Na dis make dem dey put new wine inside new wine bag, so dat di wine nor go trowey and di wine bag nor go tear.”
Jesus Heal One Woman And Wake Pesin Wey Die
18As Jesus dey tok dis tins, one oga kom knee down for en front sey, “My dota just die, make yu kom tosh am and e go wake-up.” 19So Jesus and en disciples kon follow am.
20One woman wey blood dey rush komot for en body for twelf years kon kom Jesus back, den e tosh en klot korna. 21Bikos di woman don tink am for en mind sey, “If I go fit tosh en klot korna, I go well.”
22Wen Jesus turn round si di woman, e kon tell am, “My pikin, make yu nor worry! Yor faith don make yu well.” From dat time, di woman kon well.
23Wen Jesus enter di oga house, e si pipol dey play music and plenty pipol dey make nois for der too. 24E kon tell dem, “Make evribody komot, di girl neva die, e just dey sleep.” Den, dem kon bigin laf am. 25Afta di pipol don go outside, Jesus go whole di girl for hand and di girl kon stand up! 26Pipol kon bigin tok about wetin happen for evriwhere.
Jesus Heal Pipol
27As Jesus komot for der, two blind men kon follow am dey shaut, “David pikin, make yu sorry for us!”
28Wen Jesus don enter di house, di two blind men kom meet am. Den e ask dem, “Una bilive sey I fit make una si?”
Dem ansa, “Yes Oga God, yu fit.”
29Den Jesus tosh dia eyes kon sey, “Make e happen to una as una faith strong rish.” 30At wons, dia eyes kon open and dem kon bigin si. Jesus kon warn dem sey, “Make una nor tell anybody wetin happen so.” 31But dem kon go evriwhere, bigin tok about di tin wey Jesus do for dem.
32As dem komot, some pipol bring one man wey get demon and e nor fit tok, kom meet Jesus. 33Wen Jesus don drive di demon komot, di man kon bigin tok. Di pipol wey gada for di place sopraiz well-well and dem kon sey, “Nobody don si dis kind tin for Israel before.”
34But di Farisee pipol sey, “Na devil pawa Jesus dey use take drive demon komot from pipol body.”
Pipol Wey Go Work
35Jesus waka go all di town and village, dey prish di Good News about God Kingdom for dia sinagog and dey heal difren diziz and pipol wey nor well. 36Wen e si how pipol plenty rish, e kon sorry for dem, bikos nobody dey to help dem and dem kon dey waka anyhow like sheep wey nor get who dey look dem. 37Den e tell en disciples, “Wetin pipol go harvest plenty well-well, but di pipol wey go do di work nor plenty rish.” 38So, make una pray make di Oga God wey get di farm, send pipol wey go work for en farm, kom.

Currently Selected:

Matiu 9: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in