YouVersion Logo
Search Icon

Matiu 10

10
Jesus Send En Disciples
1Jesus koll en twelf disciples kon give dem pawa to drive demons and heal diziz and pipol wey nor well.
2Dis na di twelf disciples name: Simon (wey dem dey koll Pita); Andru, wey bi Pita broda; James wey bi Zebedee pikin and en broda John, 3Filip and Bartolomew; Tomas; Matiu, wey bi tax kollector; James, wey bi Afaeus pikin and Taddaeus. 4Simon wey bi Zealot (pesin wey dey fight for en kountry) and Judas Iskariot wey sell Jesus Christ.
5Jesus send and tell dem, “Make una nor go Gentile aria go prish and make una nor enter Samaria pipol town, 6but make una go meet Israel pipol, wey bi God sheep, wey lost. 7As una dey go, make una prish di message sey, ‘God Kingdom don near!’ 8Make una heal pipol wey nor well, wake pipol wey don die; cure lepers and drive demons komot from pipol body. Na free God give una dis pawa, so make una gi-am free to oda pipol too. 9Make una nor karry any money follow body, 10or karry bag or estra dress, sandal or walkin stik, bikos di pipol wey una go meet, go give una evritin wey una wont.
11“Wen una enter any town or village, make una look for pesin wey ready to receive una for en house, make una stay with am until una komot from dat town. 12Any house wey una enter, make una greet di pipol wey dey inside. 13And if di pipol inside di house welkom una, make una peace stay with dem, but if dem nor welkom una, una peace go kom back to una. 14If di pipol nor welkom or listin to una message, make una shake dia san komot from una leg as una dey leave dat house or town. 15I tell una true word, e go betta for Sodom and Gomorrah pipol for judgement day, pass di pipol wey dey for dat town.”
Di Disciples Sofa
16“Si! I dey send una go like sheep for where plenty wiked animals dey, so make una dey wise like snake and gentol like dove.
17“Make una dey ready, bikos pipol go arrest una karry go kourt and flog una for dia sinagog. 18Bikos of mi, dem go drag una go meet rulers and kings, so dat una go tok about mi give dem and Gentile pipol. 19Make una nor worry about wetin una go tok wen dem drag una go kourt, bikos God go give una wetin to tok wen dat time rish. 20Nor bi una go dey tok, but na una Papa Spirit go dey tok thru una.
21“Broda go sell en own broda give pipol make dem kill-am and na so papa go sell en own pikin too. Shidren go fight and kill dia papa and mama. 22Evribody go hate una bikos of mi. But anybody wey fit bear rish di end, God go save am. 23Anytime dem sofa una for one town bikos of mi, make una run go anoda town. I tell una true word, una nor go run pass all di town for Israel, before Man Pikin go kom back.
24“Nobody big pass en tisha and know savant big pass en oga. 25E good make disciple bi like en tisha and savant bi like en oga. If dem dey koll oga for en house ‘Belzibub (wey mean demon oga),’ wot of di pipol wey dey di house? Dem nor go koll dem bad name too?”
Fear God, Nor Fear Man
26“Make una nor fear man, bikos nor-tin wey hide wey nor go kom out and know sekret wey pipol nor go know. 27Wetin I tell una for darkness, make una tok am for day time and wetin I tok for una ear, make una shaut am make pipol hear. 28Make una nor fear who go fit kill di body and nor fit kill di soul. Instead, make una fear God wey fit distroy pesin soul and body for hell-fire. 29Nor bi one penny dem dey sell two sparo bird? But no one go fall rish groun, escept God allow am. 30Si! God know how many hair dey for una head. 31So, make una nor fear, una betta pass many sparo.
32“Anybody wey tok for publik sey en know mi, na so mi too go tok about am give my Papa for heaven. 33But anybody wey deny mi for publik, misef go deny am for heaven.”
Nor Bi Peace, Na War
34“Make una nor tink sey, I bring peace kom dis world. No! Na war I bring. 35I kom make boy pikin nor gri with en papa and make girl pikin nor gri with en mama. Wife nor go gri with en husband mama 36and pesin worse enemy, go bi en own family pipol.
37“Anybody wey love en papa, mama and pikin pass mi, nor go fit bi my disciple. 38Anybody wey nor karry en cross follow mi, nor go fit bi my disciple. 39Pesin wey hold en life tait, go luz am, but anybody wey luz en life bikos of mi, go gain am.”
Reward
40“Pesin wey welkom yu, welkom mi too and anybody wey welkom mi, welkom di Pesin wey send mi. 41Anybody wey receive profet, bikos na profet e bi, go get profet reward. Pesin wey receive good pesin, bikos na good pesin e bi, go get good pesin reward. 42And anybody wey give kold wota to di pesin wey small pass among my disciples, I tell una true word, e nor go ever luz en reward.”

Currently Selected:

Matiu 10: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in