YouVersion Logo
Search Icon

Matiu 11

11
1Wen Jesus don tish en disciples finish, e kon komot from der go tish and prish for difren towns for Galilee.
Jesus And John Di Baptist
2Naw, wen John hear for inside prison about di tins wey Jesus dey do, e kon send en disciples go ask am: 3“Na yu bi di Mezaya wey wi dey espect or make wi wait for anoda pesin?”
4Jesus kon ansa dem, “Make una go tell John wetin una dey hear and si. 5Blind pipol dey si, pipol wey nor fit waka dey waka, God dey cure leper, deaf pipol dey hear, pipol wey don die, dey wake-up and poor pipol dey hear di Good News. 6God go bless di pesin wey nor dey vex for mi.”
7As John disciples dey go, Jesus kon tell di pipol about John: “Wetin una go desert go si? Na grass wey breeze dey blow? 8Who una go outside go si? Abi na man wey wear fine dress? Pipol wey dey wear fine dress like dat, nor bi king palis dem dey stay? 9Wetin una go si for outside? Na profet? Yes! I tell una, e even big pass profet. 10Na John bi di pesin wey dem rite for God word about sey:
“ ‘Si, I dey send pesin go yor front,
make e go prepare di way for yu.’
11I tell una true word, among all di pipol wey woman born, e nor get anybody wey big rish John di Baptist. But di pesin wey small pass for God Kingdom, big pass am. 12From John di Baptist time kon rish naw, pipol dey struggol to enter God Kingdom, but na only doz wey dey struggol well-well, dey fit enter. 13Before John kom, Moses Law and di profets dey prish about wetin go happen. 14And if una go gri with wetin I dey tok, John, na-im bi Elijah wey suppose to kom. 15Anybody wey get ear, make e hear!
16“Wetin I go sey dis time pipol bi like? Dem bi like shidren for market wey dey hala for each oda sey,
17“ ‘Wi blow flute for una,
but una nor gri dance,
wi dey kry for awa pesin wey die,
but una nor follow us kry.’
18Wen John di Baptist kom, e nor chop, drink or enjoy life but una sey, ‘E get demon!’ 19But wen Man Pikin kom, e chop and drink and una sey, ‘Si am, long-trot, drunkaman, tax kollectors and sinnas friend!’ But God wisdom dey show for wetin e dey do.”
Town Wey Nor Bilive
20Jesus kon dey curse all di town where e for do many mirakles, bikos di pipol nor gri turn from sin kom meet God. 21“E nor go betta for Korazin and Betsaida pipol! If to sey di mirakles wey dem do among una happen for Tyre and Sidon, dem for don turn from dia sin kom meet God, kon karry ashes put for head and wear tear-tear klot, 22but I tell una true word, e go eazy for Tyre and Sidon for judgement day pass una. 23Una wey bi Kapanaum pipol, una feel sey una fit karry unasef go heaven? No! God go trow una for hell-fire, bikos if to sey dem do di mirakles wey dem do for una, for inside Sodom, di town for still dey till today. 24But I tell una, God go get mesi for Sodom pass una for judgement day!”
Jesus Invite Pipol
25For dat time, Jesus kon sey, “I praiz yu Papa, Oga God wey get heaven and eart, bikos yu hide dis tins from pipol wey get sense and doz wey know book well-well, but yu show dem to small shidren. 26Yes! Papa, na so yu wont make e bi.
27“My Papa put evritin for my hand. Nobody know di pikin, but na only en Papa know am. Nobody know di Papa, but na only di pikin and anybody wey di pikin choose to show. 28Una wey don taya and karry heavy load, make una kom meet mi and I go give una rest. 29Make una follow mi and learn from mi, bikos I gentol, I nor dey karry body up and I go give una peace for una mind. 30My way eazy to follow and my load nor heavy to karry.”

Currently Selected:

Matiu 11: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in