YouVersion Logo
Search Icon

Matiu 12

12
Sabat Day Oga God
1Dat time, Jesus waka pass one korn farm for Sabat Day. En disciples kon dey plok di korn chop, bikos dem dey hongry. 2But wen di Farisee pipol si dem, dem kon tell Jesus, “Si, yor disciples dey break di law for Sabat Day.”
3Jesus ansa, “Una neva read wetin David do wen en and en pipol dey hongry, 4how dem enter God house kon chop di holy bread wey ordinary pipol nor suppose chop, bikos na only priests suppose to chop am? 5Or una neva read for Moses Law sey, priests dey work for Sabat Day, but nobody dey sey dem kommit sin? 6I tell una, pesin wey big pass di temple dey here with una naw. 7If to sey una know wetin dis tin mean: ‘Na mesi I wont, nor bi sakrifice’, una nor for kondemn pesin wey nor kommit sin. 8Man Pikin na-im bi Sabat Day Oga God.”
Jesus Heal For Sabat Day
9Den Jesus komot der kon enter dia sinagog. 10One man wey en hand die dey der. Some pipol wey dey find as dem go take akuiz Jesus kon ask, “E dey rite to heal for Sabat Day?”
11Jesus ansa, “If any of una get sheep wey fall inside pit for Sabat Day, e nor go-go karry am out? 12Human being betta pass sheep! So, e dey rite to do good for Sabat Day.”
13Den Jesus tell di man, “Stresh yor hand.” So di man stresh en hand and di hand kon strong like di oda one. 14But di Farisee pipol kon go plan as dem go take kill Jesus.
God Special Savant
15Wen Jesus hear sey dem dey plan to kill-am, e kon komot from der. Many pipol follow am and e kon heal all of dem wey nor well. 16But e warn dem sey, make dem nor tell anybody who e bi. 17Dis make wetin Profet Isaya tok, happen:
18“Na my savant wey I choose bi dis,
di One wey I love,
wey I dey happy with.
I go put my Spirit inside am
and e go judge di world.
19E nor go kworel or shaut,
nobody go hear en vois for publik,
e nor go tosh pesin wey weak,
20or kwensh di small hope wey pesin get,
until dem go stop to opress pipol.
21And en name go give hope to Gentile
and oda pipol for dis world.”
Jesus And Belzibub
22So dem kon bring one blind man wey get demon and nor fit tok, kom meet Jesus. Jesus heal am and di man kon dey si and tok. 23Di pipol sopraiz well-well kon dey ask, “Dis nor bi David pikin wey wi dey wait for?”
24But wen di Farisee pipol hear wetin dem dey tok, dem kon ansa, “Na Belzibub (wey bi demon oga) pawa e dey use take drive demons komot from pipol body.”
25Wen Jesus know wetin dem dey tink for dia mind, e kon sey, “Evry kingdom wey dey fight with ensef go skata and know town or family wey dey fight demsef, go fit stand. 26So if Satan dey drive Satan komot, e don divide ensef bi dat, den how en kingdom go fit stand? 27And if na Belzibub pawa I take dey drive demons komot, na wish pawa una shidren dey take drive demon too? Bikos of dis, una shidren go judge una. 28But if na God Spirit I take dey drive demons, den God Kingdom don already kom meet una.
29“How pesin go fit break enter strong man house kon tif en propaty, unless e first tie di strong man? Den, e go get shance tif wetin dey di house.
30“Anybody wey nor dey with mi, dey against mi and anybody wey nor join mi, dey skata my work. 31Naim make mi dey tell una sey, ‘God go forgive pipol dia sin and all di bad word wey dem tok, but anybody wey curse or tok bad word against di Holy Spirit, God nor go forgi-am.’ 32Anybody wey tok bad against Man Pikin, God go forgi-am. But anybody wey tok bad against di Holy Spirit, God nor go ever forgi-am, weda for dis life or di one wey dey kom.”
Tree And En Fruit
33“Good tree dey bear good fruit and bad tree dey bear bad fruit. Na di fruit wey tree bear, naim pipol take dey know di kind tree wey e bi. 34Una, snake shidren! How una won take tok good word since una dey wiked? Na wetin full pesin heart, naim en mout dey tok. 35As good pesin dey bring good tins from en heart, na so bad pesin dey bring bad tins from en heart too. 36I tell una true word, for judgement day, pipol go ansa God for all di yeye word wey dem tok. 37Na di word wey yu dey tok, naim go fit free or kondemn yu for God present.”
Jonah Sign
38Some of dem wey bi law tisha and Farisee pipol kon tell Jesus, “Tisha, wi wont make yu show us sign.”
39Jesus ansa, “Si dis bad and wiked pipol for dis time wey dey ask for sign, I nor go show una any sign, escept Profet Jonah own. 40As Jonah dey inside big fish belle for three days and nites, na so Man Pikin go dey for grave for three days and nites too. 41For judgement day, Nineveh pipol go kondemn di pipol for dis time, bikos wen Jonah prish give dem, dem turn from sin kom meet God. And naw, somebody wey big pass Jonah dey here with una! 42For judgement day, Sheba kween go kondemn di pipol for dis time, bikos e travel from far place kom hear Solomon wisdom. And naw, somebody wey big pass Solomon dey here with una!”
Evil Spirit Fit Kom Back
43“Wen evil spirit don komot from pesin body, e dey pass where wota nor dey, dey find where e go rest, but if e nor si, 44e go tell ensef, ‘I go-go back to di house where I from komot.’ Wen e kom back kon si sey di house empty and dem don swip and arrange am, 45e go-go bring seven spirit wey wiked pass am, kom. Dem go enter di pesin kon sidan for der, so di pesin kondishon go kon bad pass as e bi before. Na like dis e go happen to evil pipol for dis time.”
Jesus Family
46As Jesus still dey tok, en mama and brodas kon stand for outside, bikos dem won si am. 47So somebody for der kon tell Jesus, “Si, yor mama and brodas dey outside and dem won tok to yu.”
48Jesus kon ask di pesin, “Who bi my mama and brodas?” 49Den Jesus point to en disciples kon sey, “Na dis pipol bi my mama and brodas. 50Pesin wey do wetin my Papa for heaven wont, na dat pesin bi my broda, sista and mama.”

Currently Selected:

Matiu 12: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in