Jenesis 23
23
Sarah Die
1Sarah stay for one hundred and twenty-seven years. 2E die for Kiriat-Arba (wey bi Hebron naw) for Kanaan land. Abraham mourn and kry for Sarah. 3Den Abraham get up from where e for dey mourn en wife wey die kon tell Het pikin dem sey, 4“Na strenja I bi for una land and I go soon komot here, so make una give mi land where I go beri my wife put.”
5Het pikin dem ansa Abraham, 6“Oga, make yu listin to us. Yu bi prince wey get betta pawa among us! Yu fit beri yor wife for di best land wey wi get for here. All of us go happy to give yu land make yu beri yor wife put.”
7Abraham stand up kon bow for Het shidren. 8Den e tell dem, “If una gri sey make I beri my wife for here, den make una hear wetin I won tok. Make una ask Efron, Zohar son 9if e go sell Makpelah grave wey bi en own give mi; e dey di end for en field. Make e sell am give mi for evribody front for di normal prize, so dat I go beri my wife for der and e go kon bi awa burial groun.”
10(Naw Efron sidan with Hit shidren.) Efron wey bi Hit pesin kon ansa Abraham for front of Het shidren and evribody wey dey kom thru di town gate sey, 11“Okay my oga! I go sell both di field and di grave give yu. For my pipol front, I sell am give yu. Make yu go beri yor wife for der.”
12Abraham bow again for di pipol 13kon tell Efron for dia front sey, “Abeg, make una listin to mi. I go pay yu di prize for di field. Take am from mi, so dat I go fit go beri my wife for der.”
14Efron ansa Abraham, 15“My oga, di land na 400 silva, but dat one nor mean anytin at-all. So go beri yor wife for der.”
16Abraham agri with Efron prize, e give di money to am kon dey tok make evribody for hear am, “Dis na 400 silva, just as dem dey measure am dat time.” 17So Abraham kon buy Efron field for Makpelah, wey dey near Mamre, plus di field, di grave and all di land wey dey near am 18and all dem kon bi en propaty. So Het shidren and evribody wey dey enter di gate for Efron town kon bi en witness. 19Afta evritin, Abraham beri Sarah en wife for di grave wey dey Makpelah field near Mamre (wey bi Hebron naw) for Kanaan land. 20Abraham buy di field and di grave from Het shidren as where dem go dey beri pipol put.
Выбрано:
Jenesis 23: pcm
Выделить
Поделиться
Копировать
Хотите, чтобы то, что вы выделили, сохранялось на всех ваших устройствах? Зарегистрируйтесь или авторизуйтесь
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee