Psalms 32
32
To Konfess And To Forgive
Betta Song Wey David Rite
1Di pesin wey God forgive en wiked ways and sins,
make e happy!
2Yes, make doz wey God don forgive dia sins happy well-well;
doz wey dey live betta life naw!
3Wen I nor gri konfess my sins, my body kon dey die go
and I kon dey kry with pain.
4Both day and nite, God just dey ponish mi.
My strent die go like wota wey dry, bikos of heat.
5So, I konfess all my sins kon stop to hide all di bad tins wey I dey do.
I tell mysef sey, “I go konfess my sins to God.”
And E really forgive mi!
6So make evribody wey dey fear God pray to am as time still dey,
so dat dem nor go sofa for judgement day.
7Na God bi di place where I dey hide put and E dey protet mi from trobol.
God surround mi with song and happiness from doz wey E diliver.
8God sey, “I go guide and take yu pass di best road for life.
I go advise and wosh ova yu.
9So, make yu nor bi like horse or animal wey nor get sense
and wey nid kane to kontrol am.”
10Plenty trobol dey kom meet wiked pipol,
but di love wey nor dey fail, dey kover doz wey trust God.
11So, doz of una wey get pure heart and dey raitious,
make una happy well-well!
Currently Selected:
Psalms 32: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee