YouVersion Logo
Search Icon

Psalms 31

31
Prayer To Trust God
For Di Kwayamasta: David Song
1My God, na Yu dey protet mi; so make Yu nor let pipol disgrace mi.
Make Yu save mi, bikos Yu dey always do di rite tin.
2Make Yu listin to mi kon kwik diliver mi.
Make Yu bi my rock wey go dey protet mi;
di strong place where I fit hide put.
3Na Yu bi my rock and my guide.
Bikos of di honor wey yor name get,
make Yu take mi komot from wahala.
4Drag mi komot from di trap wey my enemies set for mi,
bikos na only Yu fit protet mi.
5I don put my life for yor hand.
So Oga God, make Yu diliver mi,
bikos Yu bi God wey dey faithful.
6I hate pipol wey dey serve juju,
but I trust Yu wey bi my Oga God.
7I go happy and dance for yor love wey nor dey fail,
bikos Yu don si my trobol
and Yu kare about di pains wey dey my heart.
8Yu nor give mi to my enemies
and Yu don put mi for where I go dey save.
9My Oga God, make Yu sorry for mi,
bikos I dey pass thru pain as I dey kry
and my body and soul dey die dey go.
10I dey die bikos pain and sadnes don make my years short.
Sin don finish my strent and na die I dey die so.
11All my enemies dey laf mi and my neighbours hate mi;
even my friends dey fear to waka near mi
and wen dem si mi dey kom,
dem go rush pass anoda road.
12Pipol don forget mi like sey I don die;
like sey I bi pot wey break.
13I don hear evritin wey dem dey tok and e dey make mi fear.
My enemies gada dey plan how dem go take kill mi.
14But my Oga God, I trust Yu,
bikos na Yu bi my God!
15My future dey yor hand.
Make Yu save mi from my enemies pawa, bikos dem won kill mi.
16Make yor favor shine on yor savant.
Make Yu save mi with yor love wey nor dey fail.
17My God, nor let dem disgrace mi,
bikos I dey koll make Yu kom help mi.
Instead, make disgrace follow wiked pipol
and make dem die go dia grave,
where dem go dey silent forever.
18Make Yu klose dia lie-lie mout forever;
doz pipol wey get bad mout and dey akuiz God pipol.
19Si as yor favor great rish;
di one wey Yu keep for doz wey dey fear Yu.
Yu dey pour dem on pipol wey kom make Yu protet dem
and Yu dey bless dem for evribody front.
20Yu dey guide and hide dem for yor present
and dia enemies nor go fit tosh dem or lie for dia head.
21Make praiz bi God own,
bikos E don show mi di wonderful tins
wey dey en love wey nor dey fail,
wen E save mi from my enemies.
22I kry to Yu as I dey fear kon sey,
“Dem don take mi from Yu!”
But Yu hear my kry for mesi kon ansa my prayer for help.
23All of una wey dey fear and obey God,
make una love am!
Bikos God dey protet pipol wey dey loyal to am,
but E dey vex ponish doz wey dey do wiked tins.
24So evribody wey put dia trust for God hand,
make una nor fear, instead make una get strong mind!

Currently Selected:

Psalms 31: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in