1
Psalms 31:24
Holy Bible Nigerian Pidgin English
So evribody wey put dia trust for God hand, make una nor fear, instead make una get strong mind!
Compare
Explore Psalms 31:24
2
Psalms 31:15
My future dey yor hand. Make Yu save mi from my enemies pawa, bikos dem won kill mi.
Explore Psalms 31:15
3
Psalms 31:19
Si as yor favor great rish; di one wey Yu keep for doz wey dey fear Yu. Yu dey pour dem on pipol wey kom make Yu protet dem and Yu dey bless dem for evribody front.
Explore Psalms 31:19
4
Psalms 31:14
But my Oga God, I trust Yu, bikos na Yu bi my God!
Explore Psalms 31:14
5
Psalms 31:3
Na Yu bi my rock and my guide. Bikos of di honor wey yor name get, make Yu take mi komot from wahala.
Explore Psalms 31:3
6
Psalms 31:5
I don put my life for yor hand. So Oga God, make Yu diliver mi, bikos Yu bi God wey dey faithful.
Explore Psalms 31:5
7
Psalms 31:23
All of una wey dey fear and obey God, make una love am! Bikos God dey protet pipol wey dey loyal to am, but E dey vex ponish doz wey dey do wiked tins.
Explore Psalms 31:23
8
Psalms 31:1
My God, na Yu dey protet mi; so make Yu nor let pipol disgrace mi. Make Yu save mi, bikos Yu dey always do di rite tin.
Explore Psalms 31:1
Home
Bible
Plans
Videos