Matiu 4
4
Devil Tempt Jesus Christ
1Di Holy Spirit take Jesus go inside wildaness make devil for tempt am. 2Afta Jesus don fast for forty days and forty nites, e kon dey hongry. 3Den devil kon meet am sey, “If yu bi God pikin, kommand dis stone make e turn to bread.”
4Jesus ansa, “God word sey, ‘Nor bi only food man go take survive, but na with evry word wey God tok.’ ”
5Den, devil show Jesus di holy town kon make am stand on-top di place wey high pass for di temple 6and e tell Jesus, “If yu really bi God pikin, jump go down, bikos dem rite for God word sey,
“ ‘God go kommand en angels
make dem do evritin for yu
and dem go katch yu
make yor leg nor nak stone.’ ”
7Jesus ansa am, “God word sey, ‘Make yu nor try God wey bi yor Oga God.’ ”
8Den devil take Jesus go one mountin wey high well-well kon show am all di kingdom for dis world and all di betta tins inside am. 9Devil kon tell am, “I go give yu all dis tins, if yu go bow down woship mi.”
10Jesus ansa, “Komot here, devil! Bikos God word sey, ‘Na only God wi suppose to serve and woship.’ ”
11So, devil kon leave Jesus and God angels kon bigin help am.
Jesus Prish For Galilee
12Wen Jesus hear sey dem don put John inside prison, e kon go back to Galilee. 13From der, Jesus komot from Nazaret go Kapanaum wey near di sea, where Zebulun and Naftali pipol dey stay, 14so dat wetin Profet Isaya tok, go happen:
15“Zebulun and Naftali di place
where river for cross Jordan River go Galilee,
where pipol wey nor bi Jew dey stay,
16una wey dey darkness,
don si big lite
and una wey don nearly die,
don get life.”
17From dat time, Jesus bigin prish sey, “Make una turn from sin kom meet God, bikos God Kingdom don kom meet una.”
Jesus Choose En Disciples
18As Jesus dey waka for Galilee wotaside, e si two brodas, Simon wey dem dey koll Pita and Andru en broda, dem dey trow net inside di river dey katch fish. 19Jesus kon tell dem, “Make una follow mi and I go make una katch pipol.” 20At wons, dem leave dia net kon follow Jesus.
21As Jesus komot from der, e kon si two brodas, James and John, with Zebedee dia papa, dey ripair net inside dia boat. Den Jesus koll di brodas. 22Kwik-kwik dem run leave dia papa inside di boat, kon follow Jesus.
Jesus Heal Pipol
23Jesus kon dey waka for Galilee dey tish inside dia sinagog. E prish about God Kingdom and dey heal pipol wey get difren-difren diziz and doz wey nor well. 24So di news about Jesus kon spread go evriwhere for Siria. Dem kon bring pipol wey nor well, wey nor fit waka, pipol wey devil dey worry and di pipol wey demon dey inside dem, kom meet am and e heal all of dem. 25Many pipol from Galilee, Dekapolis, Jerusalem, Judea and pipol wey dey stay near Jordan River, kon follow am.
Currently Selected:
Matiu 4: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee