Jenesis 41
41
Fero First And Sekond Dream
1Afta two years, Fero kon dream. As e stand near River Nile, 2e kon si seven melu wey fat and fine well-well dey kom out from di river go chop for di field. 3Den e si seven melu wey dirty and tin dey kom for dia back from di river too and dem stand near di fat ones. 4Den, di tin melu kon swallow di seven fine and fat melu and Fero kon wake-up.
5Den e sleep again kon dream anoda dream: E si seven korn head dey grow for one korn stik and dem dey fine and big well-well. 6Den e still si anoda seven korn head wey tin and wey sun don burn small and dem dey grow kom out too. 7Di seven tin korn kon swallow di seven fat and fine ones. Den Fero wake-up kon si sey na dream e dey dream.
8For morning, en mind nor rest, so e sey make dem koll all en majishan, priest, doz wey dey si wetin go happen and juju pipol for Egypt. Fero tell dem en dreams, but nobody fit tell am wetin dem mean. 9Den di man wey dey serve wine for Fero kon tell am, “Na today I know sey I don sin. 10I remember wen Fero vex for mi en savants kon put mi for prison for di bodyguards oga house; both mi and di shief baker. 11Wi two dream difren dream for di same nite and di dream get dia own meaning. 12Naw e get one yong Hibru man for der and e bi di guide oga savant. Wi tell am wetin wi dream and e tell di two of us wetin awa difren dreams mean. 13Evritin happen just as e tell us. Fero give mi my work back kon hang di shief baker.”
14Den Fero sey make dem go koll Josef kom. So dem take Josef kwik-kwik komot from di prison kon shave en hair and shange en klot, den dem take am go meet Fero. 15Fero kon tell Josef, “I dream one kind dream and e nor get anybody wey fit tell mi wetin di dream mean. But I don hear about yu sey yu dey fit tell pipol wetin dia dream mean.”
16Josef kon ansa Fero, “I nor get dat kind pawa, but God go tok thru mi, so dat yu awa king go dey okay.”
17Den Fero tell Josef, “I dream sey I stand near Nile river. 18Den I si seven melu wey fine well-well dey kom out from di river go chop for di field. 19Den I still si seven dirty and tin melu dey kom for dia back from di river too and dem stand near di fat ones. I neva si dat kind dirty and tin melu before. 20Di dirty melu kon swallow di fine ones. 21Wen dem don chop di fat ones finish, nobody go know sey dem chop anytin, bikos dem still tin as dem bi. Den I kon wake-up.
22“I still dream si seven korn head dey grow for one korn stik and dem fine and big well-well. 23Den I si anoda seven korn head wey tin and wey sun don burn small dey grow kom out too. 24Di tin ones kon swallow di fat ones. So I tell all my priest and majishan, but nobody fit tell mi wetin di dreams mean.”
25Den Josef tell Fero, “Di two dream wey Fero dream get di same meaning. God don show Fero wetin E wont do. 26Di seven fat melu na seven years and di seven good korn na seven years too. Di two dreams get di same meaning. 27Di seven tin melu wey kom afta di fat ones na still seven years and di bad korn wey still kom afta di good ones, na seven years wen honga go dey. 28Dis na wetin I go tell Fero: God don show Fero wetin E won do. 29Seven years dey kom wen good tins go happen for Egypt. 30But afta dat seven years, anoda seven years wey honga go dey evriwhere dey kom and evribody go forget di first seven years. Di honga go konfuse di land. 31Pipol nor go remember di tins wey di land get before, bikos di honga go strong well-well. 32God show Fero di dream two times, bikos na as God wont make e bi, bi dat and God go soon make am happen.
Josef Advise Fero
33“So make Fero fine one man wey good and get sense kon make am oga ova di land for Egypt. 34Den make Fero choose one pesin wey go supavise di whole land for Egypt, so dat if dem divide all di tins for Egypt into ten, dem go kollect five part keep for di time wen evritin dey good. 35For dis good years wey dey kom, make dem gada all di food wey remain. And make Fero kommand dem to keep korn and oda tins, so dat di town go get food and dem go dey keep dem. 36Make dem keep all dis food for di land until di seven years wey honga go dey, go start. Like dis, di land go fit survive di honga.”
Fero Make Josef Govnor
37Dis advise dey good for Fero ear and all en ofisas. 38So Fero kon ask en ofisas, “Wi go fit si anoda pesin wey bi like Josef, pesin wey God Spirit dey with?” 39So Fero tell Josef, “Bikos God don make yu know all dis tins, e nor get anybody wey wise and good like yu! 40Na yu go take kare of my house and all my pipol go obey yor kommand. Na only mi, di king go dey great pass yu.”
41Fero kon tell Josef, “Si! I don put yu as oga ova evribody for Egypt.” 42Den Fero take en own ring from en hand kon wear am for Josef own. E wear en fine klot for Josef kon put gold shain for en neck. 43Fero gi-am di shariot wey di pesin afta di king dey ride and e sey, “Make una knee down for am!” So Fero make am oga ova all di land for Egypt. 44Fero still tell Josef, “Na mi bi Fero, but unless yu sey so, nobody go ever fit enter Egypt.”
45Fero kon koll Josef, Zafenat-Paneah. E still gi-am Asenat wey bi Potifara dota, priest for On, so dat di woman go bi Josef wife. So Josef kon dey kontrol di whole Egypt. 46For dis time, Josef na thirty years wen e start to serve Fero and dey kommand evribody for Egypt. Na Fero make Josef oga for di whole Egypt.
47For di seven years wey food dey, wetin di land produce kon many well-well. 48Josef take all di food wey remain for Egypt for dat seven years kon keep dem for di main towns. Josef keep food wey dem gada for all di towns. 49Di korn and rice wey Josef keep, many well-well like san-san wey dey near sea and e nor fit measure dem again, bikos dem too plenty.
50Asenat, Priest Potifara for On pikin, wey bi Josef wife, born two sons for Josef before di honga start. 51Josef koll di first-born Manasseh kon sey, “True-true, God don make mi forget all my wahala and my papa house,” 52E koll di sekond boy, Efraim bikos e sey, “True-true, for di land where I for dey sofa, God don make mi fruitful.”
53Den di seven years wen tins good for Egypt kon finish. 54And di seven years for honga kon start just as Josef tok sey e go bi. Honga dey for di whole world, but food dey for Egypt. 55Wen evribody for Egypt don dey sofa, bikos of di honga, di pipol kon kry go meet Fero make e give dem food. But Fero tell dem, “Make una go meet Josef and anytin wey e tell una, make una do am.” 56As di honga dey evriwhere for di world, Josef kon open di store where e keep food put kon dey sell food give Egypt pipol. Di honga for di whole Egypt strong well-well. 57Pipol from evry kountry dey kom buy food from Josef for Egypt, bikos di honga strong well-well.
Currently Selected:
Jenesis 41: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee