Jenesis 40
40
Josef Interpret Two Dreams
1Afta all dis tins don happen, di pesin wey dey serve wine for Egypt king and di pesin wey dey bake en bread kon make am vex. 2Fero wey bi king, vex well-well for en two ofisas 3so e kon arrest dem put for prison for di bodyguard oga house where dem put Josef too. 4Di oga for di guards kon choose Josef as di pesin wey go dey serve di two ofisas for prison. Dem stay for prison tey small.
5One day, di two of dem; both di pesin wey dey serve wine and di baker for Egypt wey dey prison kon dream. Each of dem dream get en own meaning. 6Wen Josef meet dem for morning, e si sey dia face nor dey okay. 7So e ask Fero ofisas wey dey prison with am for en masta house, “Wetin make una face bi like dis today?”
8Dem ansa, “Wi dream one kind bad dream, but e nor get anybody wey fit tell us wetin di dreams mean.”
Josef ansa, “Nor bi God dey tell pipol wetin dreams mean? Make una tell mi di dream.”
9So di one wey dey serve wine kon tell Josef en dream: “Inside my dream, e get one vine for my front. 10Di vine get tree branches. Di vine kon dey grow dey fine and e kon dey produce ripe-ripe grape. 11Fero cup dey my hand, so I take di grape kon press am put for di cup den give di cup to Fero.”
12Den Josef tell am, “Na wetin yor dream mean bi dis: di three branches na three days. 13For three days time, Fero go karry yu go back to yor ofis and yu go dey serve wine for Fero as yu dey do before. 14But make yu remember mi wen evritin dey okay with yu and make yu menshon mi to Fero wen di time rish, so dat I go komot from dis prison. 15Bikos dem buy mi kom from Hibru land and for der, I nor do anytin wey make dem put mi for gutta.”
16Wen di man wey dey bake bread si sey di meaning dey good, e kon tell Josef, “I still dream too: three kake basket dey my head, 17and for di one wey dey top, difren kind food wey dem bake for Fero dey inside, but di birds dey chop am from di basket wey dey my head.”
18So Josef ansa, “Na wetin yor dream mean bi dis: di three basket na three days. 19For three days time, Fero go sey make dem hang yu for tree. Den birds go kom chop yor flesh.”
20So e happen sey for di third day, wey bi Fero birtday, e kon do party for all en savants and e sey make dem release both di man wey dey serve am wine and di one wey dey bake. 21Di one wey dey serve wine, Fero gi-am en work back. 22But e hang di baker, just as Josef tell dem before. 23But di man wey dey serve wine nor remember Josef again and e kon forget am.
Currently Selected:
Jenesis 40: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee