Jenesis 39
39
Josef And Potifa Wife
1Naw, dem kon take Josef kom Egypt and Potifa, one Fero offisa and di bodyguard oga for Egypt kon buy Josef from Ishmael pipol wey bring am kom der.
2God dey with Josef and evritin dey betta for am, even as e dey for en Egypt oga house. 3En oga kon si sey God dey with am and God dey make evritin wey Josef do, betta. 4Potifa kon like Josef well-well as Josef dey serve am, so e make am oga ova all di savants for en house and evritin wey e get. 5From dat time, Potifa make Josef as pesin wey go dey kare for evritin wey dey en house and God kon dey bless Potifa house. Bikos of Josef, God blessing dey for evritin wey e get, both for di house and for di field. 6So Potifa leave evritin wey e get for Josef make e kare for dem. So di only tin wey koncern Potifa for di house, na to chop.
Josef fine well-well and e get betta karata. 7Afta sometaim, en oga wife kon dey like am, den di woman tell am, “Make yu kom sleep with mi.” 8But Josef nor gri and e sey, “Si, bikos of mi, my oga nor even dey borda shek anytin for di house again and e don make mi dey kontrol evritin wey e get. 9Na mi big pass for dis house and my oga don give mi evritin escept yu, bikos yu bi en wife. So wetin go make mi do dis kind wikedness kon sin against God?”
10As di woman dey tok to Josef evriday sey make e sleep with am or stay small with am, Josef nor dey listin to am. 11But one day wen Josef enter inside di house go do en work and all di oda savants nor dey inside di house, 12di woman kon hold en klot dey sey, “Make yu sleep with mi.” But e run komot di house kon leave en klot for di woman hand.
13Wen di woman si sey Josef don leave en klot for en hand run komot from di house, 14e kon koll di men for di house dey sey, “Si, my husband don bring one Hibru pesin make e kom take us do yeye. Josef won kon sleep with mi naim I shaut well-well. 15As Josef know sey I dey shaut and kry, e kon run komot di house, but e forget sey en klot dey near mi.”
16So di woman keep di klot until en husband kom, 17den e tell am di same story sey, “Di Hibru savant wey yu bring kom dis house, waka enter my room won kon take mi do yeye. 18But as soon as I bigin shaut dey kry, e kon run komot di house and e leave en klot.”
19As di oga hear di word wey en wife tell am sey, “Dis na how yor savant trit mi,” e kon dey vex for Josef. 20So Josef oga karry Josef go put for prison. Na only pipol wey di king arrest dey-dey for di prison where dem karry Josef go. 21But God dey with Josef kon show am as E love am rish and E make di pesin wey dey guide di prison, love Josef well-well too. 22So di pesin wey dey guide di prison put all di prisonas for Josef kare. Na Josef bi oga for evritin wey dem dey do. 23Di pesin wey dey guide di prison nor kare about anytin wey dem sey make Josef do or look afta, bikos God dey with Josef. Anytin wey e do, God dey make am susid.
Currently Selected:
Jenesis 39: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee