Jenesis 27
27
Jakob Kollect Esau Blessing
1Wen Isaak don old well-well and e nor dey si well again, e koll en senior pikin Esau kon tell am, “My pikin!”
Esau ansa, “Papa, na mi bi dis!”
2Isaak tell am, “Since I don old, I fit die anytime. 3So make yu take yor weapons go katch animal kom for mi. 4Make yu prepare betta food for mi, di kind one wey yu know sey I love, den bring am kom meet mi. Den I go chop kon bless yu before I die.”
5As Isaak dey tok to Esau, Rebekah dey one korna dey listin. Wen Esau don go katch di animal, 6Rebekah kon tell en pikin Jakob, “Si, I hear wen yor papa dey tell yor broda Esau sey, 7‘Make yu go katch animal for mi kon kook dem make I chop, den I go bless yu for Oga God present, before I go die.’ 8Naw, my pikin, make yu do as I tell yu! 9Go where di animals dey kon kill one of di goats. I go prepare dem make e sweet well-well as yor papa dey like am. 10Den yu go take am go give yor papa. E go chop am kon bless yu before e die.”
11But Jakob kon tell en mama, “My broda Esau get hair full body and my skin smooth! 12My papa fit tosh mi! Den e go tink sey I dey fool am and e go curse mi instead of am to bless mi.”
13So en mama tell am, “My Pikin! Any curse wey dem curse yu, I go use my head karry am! Make yu just obey mi! Just go get dem for mi!”
14So Jakob take di goat go give en mama. Di woman kon kook some sweet food, just as Isaak dey like am. 15Den Rebekah take en senior pikin, Esau best klot wey e get for house kon wear am for Jakob. 16E put di goat skin for en hand and di part wey smooth for en neck. 17Den di woman karry di food wey e make, give Jakob. 18Jakob go meet en papa kon sey, “My papa!”
Isaak ansa, “Na mi bi dis. Wish of my pikin dey tok?”
19Jakob ansa en papa, “Na mi Esau, yor first pikin. I don do as yu tell mi. Naw sidan make yu chop, so dat yu go bless mi.”
20But Isaak ask en pikin, “Na how yu take kill di animal just naw just naw?”
Jakob ansa, “Na di Oga yor God help mi.”
21Den Isaak tell Jakob, “My pikin, make yu kom near mi, so dat I go fit tosh yu kon know if yu really bi Esau.” 22So Jakob waka go near en papa Isaak and Isaak tosh am kon sey, “Di vois bi like Jakob own, but di hand bi like Esau own.” 23E nor know Jakob bikos hair full en hand like en broda Esau own. So Isaak bless Jakob. 24Den e ask am, “Yu sure sey na yu bi Esau?”
Jakob ansa, “Na mi na!”
25Isaak kon tell am, “My pikin, make yu bring some for di bush meat make I chop. Den I go bless yu wen I chop finish.” So Jakob take some for di bush meat go give en papa and Isaak chop am. E still gi-am wine drink too. 26Den en papa Isaak kon tell am, “My pikin, make yu kom here kon kiss mi.”
27So Jakob waka go kiss am. Wen Isaak feel as en klot dey smell, e kon bless am sey,
“Yes, my pikin dey smell
like sey e dey inside bush
wey God don bless.
28Make God give yu di dew from di sky
and di good tins wey dey di eart,
plus many korn and wine.
29Pipol go serve yu
and nashons go bow to yu.
Na yu go bi oga ova yor broda
and yor mama shidren go bow for yu.
Anybody wey curse yu, curse go dey en head
and blessing go follow doz wey bless yu.”
Esau Beg En Papa
30As Isaak just bless Jakob finish and as Jakob dey waka leave am, en broda Esau just dey kom back. 31Esau too prepare sweet food won go give en papa. Esau kon tell en papa. “My papa, get up make yu chop some bush meat wey yor pikin kook, so dat yu go bless mi.”
32En papa Isaak ask am, “Na who yu bi?”
Esau ansa, “Na mi bi yor first-born, Esau!”
33Isaak kon dey shake well-well, so e ask, “Den na who kon give mi bush meat chop? I chop evritin before yu kom and I bless di pesin. And blessing go really follow am!”
34Wen Esau hear wetin e papa tok, e shaut kon dey kry well-well. E kon tell en papa, “Papa, make yu bless mi too!”
35But Isaak ansa, “Yor broda Jakob don kon deceive mi kollect yor blessings.”
36Esau still sey, “En name really na Jakob! E don kollect two tins for my hand naw! E first kollect my rite as senior and naw si, e don take my blessing!” Den e ask en papa, “Yu nor keep any blessing for mi?”
37Isaak ansa, “Si! I don make am oga ova yu. I don make evribody wey rilate to am to bi en savant kon bless am with many korn and wine. Wetin dey naw wey I go fit do for yu, my pikin?”
38Esau kon tell en papa, “My Papa, so yu nor get only one blessing for mi? Abeg make yu bless mi too!” Den Esau kon dey kry well-well.
39So en papa Isaak kon tell am,
“True-true, where yu dey
nor go get di good wey di land dey give
and di dew for di sky nor go fall for yor place.
40Na so-so swod yu go take dey fight
and yu go serve yor broda.
But wen e don taya yu,
den yu go free yorsef from all dis tins.”
41So Esau kon hate Jakob, bikos of en blessing wey en papa give en broda. Esau kon tell ensef sey, “Di time to mourn for my papa don near, den I go kill my broda Jakob!”
42Wen Rebekah hear wetin en senior pikin, Esau tok, e koll en yonga pikin Jakob kon tell am, “Si, yor broda Esau dey try to revensh, so e don sey e go kill yu. 43Naw, my pikin make yu do wetin I tok. Run naw-naw go meet my broda, Laban for Haran. 44Make yu stay with am small, until yor broda Esau nor dey vex for yu again. 45Make yu stay der until Esau nor dey vex and e don forget evritin wey yu do am. Den I go send pesin make dem bring yu kom back. I nor fit luz di two of una for di same day.”
Jakob Go Meet Laban
46Den Rebekah tell Isaak, “I nor dey happy bikos of dis Het dotas. E betta make I die, instead of Jakob to marry one among dis Het dotas wey dey dis land!”
Currently Selected:
Jenesis 27: pcm
Highlight
Share
Copy
![None](/_next/image?url=https%3A%2F%2Fimageproxy.youversionapi.com%2F58%2Fhttps%3A%2F%2Fweb-assets.youversion.com%2Fapp-icons%2Fen.png&w=128&q=75)
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee