Jenesis 28
28
1So Isaak koll Jakob kon bless am. Den e kommand am sey, “Make yu nor marry any Kanaan woman! 2Make yu dey go Paddan Aram naw-naw! Make yu go Betuel house wey bi yor mama papa kon find wife for der among yor mama broda Laban dotas. 3God wey get pawa well-well go always bless yu! E go make yu dey fruitful kon give yu plenty shidren! Den yu go bi very big nashon. 4E go give yu and yor shidren-shidren di blessing wey E give Abraham, so dat una go take di land wey God give Abraham; di land wey yu just dey stay as strenjas.”
5So Isaak send Jakob go and e go Paddan Aram go meet Betuel pikin Laban, di Aramean wey bi en mama Rebekah, broda.
Esau Marry Again
6Esau si sey Isaak don bless Jakob kon send am go Paddan Aram, so dat e go get wife for der. As Isaak dey bless am, e kommand am, “Make yu nor marry Kanaan woman.” 7Jakob obey en papa and mama kon go Paddan Aram. 8Na den Esau kon know sey en papa nor like di wimen from Kanaan. 9So Esau go Ishmael kon marry Mahalat wey bi Nebaiot sista and na Ishmael, Abraham pikin born am. E marry dis one join di wifes wey e get before.
Jakob Dream
10But Jakob komot Beersheba kon go Haran. 11E rish one place where e stay small, bikos evening don dey rish. E take one among di stones kon put am near en head. Den sleep kon katch am for dat place 12and e kon dream. E si one strait road wey from eart go rish heaven and God angels dey waka up-and-down for di road, 13den Oga God stand for di top.
God kon sey, “Na mi bi di Oga God, yor grand-papa Abraham and yor papa Isaak God. Dis groun wey yu sleep put so, I go gi-am to yu and yor shidren-shidren. 14Yor shidren-shidren go plenty like san-san for groun and dem go skata go west, east, nort and sout. I go bless all di family for di world with yu and shidren-shidren name. 15I go dey with yu! I go guide yu for anywhere wey yu dey go kon bring yu kom back to dis land. I nor go leave yu until I don do wetin I promise yu!”
16Den Jakob wake-up kon sey, “True-true, God dey dis place and I nor know!” 17Bikos e dey fear, e kon sey, “Wish kind wonderful place bi dis! Dis nor bi any oda place, but na God house! Dis na heaven gate!” 18Very early for di next morning, Jakob take di stone wey e put near en head kon keep am as holy stone. Den e pour oil on-top am. 19E koll di place Bethel, even doh di name before na Luz.
20Den Jakob promise sey, “If God dey with mi kon guide mi thru dis journey wey I dey do so and E give mi food make I chop with klot to wear 21and I go back to my papa house sey nor-tin do mi, den di Oga God go bi my God. 22Den dis stone wey I dey keep der as holy stone, go bi God house and I go make sure sey I give Yu back one out of evry ten tin wey Yu give mi.”
Currently Selected:
Jenesis 28: pcm
Highlight
Share
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee