Den Jakob promise sey, “If God dey with mi kon guide mi thru dis journey wey I dey do so and E give mi food make I chop with klot to wear and I go back to my papa house sey nor-tin do mi, den di Oga God go bi my God. Den dis stone wey I dey keep der as holy stone, go bi God house and I go make sure sey I give Yu back one out of evry ten tin wey Yu give mi.”