YouVersion Logo
Search Icon

Deutronomi 14

14
Holy And Unholy Tins
1Since una bi Oga God shidren, make una nor ever kut unasef or shave una hair sey una dey kry for who don die. 2Bikos una dey holy to di Oga una God, na-im make am choose una as en pipol wey E love pass among evry oda tin for dis world. 3Make una nor chop anytin wey dem dey forbid. 4Dis na di animals wey una fit chop: melu, sheep, goat, 5gazelle, deer, wiked goat, antelope, wiked oryx and di sheep for mountin. 6Una fit chop animals wey dia leg divide into two and dey shew grass, 7but if di animal nor get am, make una nor chop am. So make una nor chop kamel, hare or hyrax. Dem dey really shew grass, but dia leg nor divide, so dem nor dey klean to chop. 8Make una nor chop pig. E get strong leg wey divide, but e nor dey shew, so e nor dey klean. Make una nor chop dis animals or even tosh dia dead body. 9For all di animals wey dey for river, una fit chop anytin wey get both fins and skales. 10But make una nor chop any animal for wota wey nor get fins and skales, bikos dem nor dey klean. 11Una fit chop any bird wey dey klean. 12Di birds wey una nor go chop na: eagle, vulture, black vulture, 13kite, falkon, any buzzard, 14any kind raven, 15ostrich, owl, seagul, any kind hawk, 16small owl, big owl or barn owl, 17owl for wildaness, Egypt vulture, kormorant, 18stork, any kind herons, hoopoe and bat. 19Any insect wey dey waka for groun with feada nor dey klean for una and make una nor chop dem. 20But una fit chop any bird and insect wey dey fly, bikos dem dey klean. 21Make una nor chop anytin wey die on en own. Una fit gi-am to strenja wey dey stay una town or una fit sell am give strenjas. But make una nor chop am at-all, bikos una bi di Oga una God pipol. Make una nor kill or chop small goat wey still dey suck breast.
Tithe
22Una must make sure sey una dey give God one from evry ten tin wey una get or harvest dat year. 23Una go bring am kom di Oga una God present, so dat en go chop from una plant, new wine, olive oil and evry first-born for una animal. Una go bring am kom meet am for di place wey E choose sey una go for honor en name, so dat una go learn to always woship di Oga una God. 24Wen E bless una, if di place where E choose sey una go for honor en name dey far, 25una fit sell all doz tins kon travel with di money wey una sell am go di place wey di Oga una God don choose by ensef. 26Wen una rish der, una fit use di money take buy any food wey una wont, plus kattle, sheep, goats, wine or beer and anytin wey una like. Den make una do party for di Oga una God present kon celebrate with una family. 27Make una nor forget Levi pipol wey dey una town, bikos dem nor get land or propaty among una. 28For di end of evry three years, una go bring all di tithe for dat year harvest kom, den keep am for di town wey dey near where God choose. 29Make una gi-am to Levi pipol, bikos dem nor get land or propaty among una. Make una still give to di strenjas wey dey stay with una; shidren wey nor get papa and mama and wimen wey dia husband don die, so dat dem go chop beleful. Den di Oga una God go bless una for evritin wey una dey do.

Currently Selected:

Deutronomi 14: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in