Deutronomi 13
13
Nor Woship Oda Gods
1May bi una get profet or doz wey dey si wetin go happen among una and dem kon show una signs and wonders, 2den wetin dem show una kon happen. If dem sey, “Make una kom make wi woship oda gods; gods wey una neva sey before.” 3Doz profets wey dey si wetin go happen, make una nor listin to dem, bikos di Oga una God go dey test una, to know weda una love am with all una mind and heart. 4Una must follow di Oga una God kon woship only en and una must follow en kommandment, obey, serve and always dey loyal to am. 5But for di profet and doz wey dey si wetin go happen, make una kill dem, bikos dem won make pipol sin against di Oga una God wey take una komot from Egypt where una for bi slave. Una must kill dem, bikos dem dey try to deceive una komot from di way wey God wont make una follow. So like dis, una must skata and distroy evry bad tin or pipol wey dey among una.
Lie-lie Profet
6Weda na una broda, pikin, wife or friend kon tok and wont make una serve oda gods wey una or una grand-grand papa nor know before, 7or if dem wont make una woship doz oda pipol gods, 8make una nor do am or listin to dem. Make una nor sorry for dem or protet dem. 9Una must kill dem! Make una bi di first to attack dem and evry oda pesin go join una. 10Una must stone dem die, bikos dem try to make una turn from di Oga una God wey diliver una from Egypt, di place where una for bi slave. 11Den, Israel pipol go hear about am kon fear and nobody go won do wiked tins again.
To Serve Juju
12Wen una don start to stay for di land, una fit hear sey, 13some wiked pipol don leave una go tok to pipol wey dey di land before sey, “Make wi go serve and woship anoda god.” (Gods wey una neva si before.) 14For dis kind matter, una must look di kase well-well. If una find out sey dis bad tin wey happen, na true, 15den make una make sure sey una kill all doz wey dey di town; plus all di animals wey dem get. 16Una must gada all di dirty for der kon put am for di street centre, den burn di town rish groun as ofrin to di Oga una God. Una must distroy di town forever and make nobody build am again. 17Anytin wey God sey E go judge, una must nor take am at-all. Den God nor go vex again, but E go sorry for una kon make una plenty as E promise una grand-grand papa. 18Di Oga una God go sorry for una only if una listin to en vois, keep en kommand wey I tell una kon dey do wetin dey good for en eye.
Currently Selected:
Deutronomi 13: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee