“Wen una dey fast, make una nor skwiz una face like pipol wey dey pritend, so dat pipol go si sey dem dey fast. I tell una true word, dem don already get dia full reward. But wen una dey fast, make una wosh and rub pomade for una face, so dat odas nor go know sey una dey fast, but only una Papa wey dey for sekret go know. And una Papa wey dey si for sekret, go reward una.”