1
Matiu 5:15-16
Holy Bible Nigerian Pidgin English
Pesin nor dey lite lamp kon kover am with basin, instead e go put am for where evribody wey dey inside di house go si am. Like dat too, make yor lite shine well-well for where pipol dey, so dat dem go si di good tins wey yu dey do, wey go make dem praiz yor Papa wey dey heaven.”
Compare
Explore Matiu 5:15-16
2
Matiu 5:14
“Na una bi lite for dis world and town wey dey on-top mountin, nor dey hide.
Explore Matiu 5:14
3
Matiu 5:8
God go bless una wey get pure heart, na una go si God.
Explore Matiu 5:8
4
Matiu 5:6
God go bless una wey dey like to do good tins, E go give una evritin wey una wont.
Explore Matiu 5:6
5
Matiu 5:44
But I tell una naw sey, ‘Make una love una enemies and pray for pipol wey dey sofa una’
Explore Matiu 5:44
6
Matiu 5:3
“God go bless una wey dey poor for spirit, na una go get heaven.
Explore Matiu 5:3
7
Matiu 5:9
God go bless una wey dey make peace, pipol go koll una God shidren.
Explore Matiu 5:9
8
Matiu 5:4
God go bless una wey dey mourn, bikos E go make una happy.
Explore Matiu 5:4
9
Matiu 5:10
God go bless una wey dey sofa bikos una dey do wetin dey rite, na una go enjoy God Kingdom for heaven.
Explore Matiu 5:10
10
Matiu 5:7
God go bless una wey dey sorry for pipol, una go receive mesi.
Explore Matiu 5:7
11
Matiu 5:11-12
“God go bless una wey pipol dey curse, dey sofa and lie for una head, bikos of mi, make una happy and make belle sweet una, bikos na big tin dey wait una for heaven. Make una remember sey, na so di profets wey kom before una, sofa too.”
Explore Matiu 5:11-12
12
Matiu 5:5
God go bless una wey nor dey karry body up, una go enjoy en promise for dis world.
Explore Matiu 5:5
13
Matiu 5:13
“Na una bi salt for dis eart. But if salt nor get taste; how e go bi for pipol mout? E betta make dem trowey am and make pipol mash am.
Explore Matiu 5:13
14
Matiu 5:48
So make una dey pafet as una Papa wey dey for heaven, pafet.”
Explore Matiu 5:48
15
Matiu 5:37
Wen yu sey, ‘Yes,’ make yu mean am and wen yu sey ‘No,’ make yu mean am too. Any oda tin wey yu tok pass dis, na devil e from kom.”
Explore Matiu 5:37
16
Matiu 5:38-39
“Una hear sey, ‘Anytin anybody do una, make una do am back.’ But I tell una, make una nor fight, if anybody slap yor face, turn di oda side gi-am too.
Explore Matiu 5:38-39
17
Matiu 5:29-30
If yor rite eye go make yu sin, make yu plok am komot. E betta sey one part for yor body nor dey, dan sey all yor body enter hell-fire. If yor rite hand go make yu do bad tin, make yu kut am trowey! E betta sey one part for yor body nor dey, dan sey all yor body enter hell-fire.”
Explore Matiu 5:29-30
Home
Bible
Plans
Videos