Matiu 6:19-21
Matiu 6:19-21 PCM
“Make una nor just gada propaty for dis world, bikos siti-siti go chop dem or dem go rust or tif fit enter inside di house tif dem. But make una gada betta tins for unasef for heaven, where siti-siti nor go for fit chop dem and dem nor go rust and tif nor go fit enter tif dem, bikos, where una propaty dey, na der una heart go dey too.