Bikos di Oga una God dey take una enter one betta land; land wey get betta river and wota, with fountain wey dey flow for di valley and hill. Betta land wey get wheat, barley, vines, fig trees, pomegranates, olive oil and honey; land where una go for chop as una like and una go get evritin. Betta land where stones bi like iron and una go fit make koppa from en hills.