YouVersion Logo
Search Icon

Deutronomi 8

8
Remember God
1Make una make sure sey una dey obey all di kommandment wey I dey give una today. Den una go get long life kon many as una enter and stay for di land wey God promise sey E go give una grand-grand papa. 2Make una remember how di Oga una God guide una pass di wildaness for dis forty years, so dat E go fit honbol and test una to si if una go fit keep en kommand or not. 3True-true! E make una dey honbol thru honga kon dey give una food wey una nor know (manna) make una chop. E do dis to tish una sey human being nor nid only food, but dem still dey alive bikos of wetin God tok. 4For dis forty years, una klot nor even tear and una leg nor get sore at-all. 5Make una tink am well. Just as papa and mama dey ponish dia pikin, na so too di Oga una God ponish una for una own good.
6So make una obey di kommand wey di Oga una God give una kon do as E tok and always dey fear am. 7Bikos di Oga una God dey take una enter one betta land; land wey get betta river and wota, with fountain wey dey flow for di valley and hill. 8Betta land wey get wheat, barley, vines, fig trees, pomegranates, olive oil and honey; 9land where una go for chop as una like and una go get evritin. Betta land where stones bi like iron and una go fit make koppa from en hills. 10Una go chop beleful kon praiz di Oga una God, bikos of di good land wey E give una.
Remember Di Blessing
11Make una make sure sey una nor forget di Oga una God. Make una dey keep en kommand and law wey I dey give una today. 12Bikos wen una go don get propaty well-well kon build many fine house to stay 13and get many animals and many silva and gold, plus evry oda tin, 14make una nor kon dey do like sey una too important, den forget di Oga una God wey bring una kom out from Egypt where una for bi slaves before. 15Na dis God take una pass di wildaness wey get wiked snakes and skorpions; place where wota nor dey. But God make wota flow for una from rock kon 16feed una for di wildaness with manna (food wey una grand-grand papa nor ever know), so dat E go honbol and test una, den make una betta pipol. 17E do all dis tins, so dat una nor go kon dey tell unasef sey, “Na my own pawa and work, I take get all dis tins.” 18Una must remember di Oga una God, bikos na en dey give pipol di pawa to make money. If una obey am, di kovenant wey E make with una grand-grand papa, E go make am happen for una life.
19But if una forget di Oga una God for evritin kon dey follow oda gods, dey woship and bow for dem, I go tell una today sey, God go really distroy una. 20Just like di pipol wey God won distroy for una, na so too E go do to una, bikos una nor gri follow en kommand.

Currently Selected:

Deutronomi 8: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in