Den wen di Oga una God take una enter di land wey E promise una grand-grand papa, Abraham, Isaak and Jakob sey E go give una; di land wey get big and fine-fine towns wey una nor build at-all and house where betta tins full, tins wey una nor buy with una hand. For di land, una go fetch wota from well wey una nor dig and una go chop from vineyards and olive trees wey una nor plant, so make una dey kareful, so dat una nor go forget God wey take una komot Egypt.