1
Deutronomi 5:16
Holy Bible Nigerian Pidgin English
Make una honor una papa and mama, just as di Oga una God don kommand una, so dat una go get long life and e go dey well with una for di land wey E won give una.
Compare
Explore Deutronomi 5:16
2
Deutronomi 5:33
Make una dey do just as E kommand una, so dat una nor go die; evritin go dey well with una and una go stay long for di land wey una dey go.
Explore Deutronomi 5:33
3
Deutronomi 5:9-10
Make una nor woship or serve dem, bikos mi wey bi una God dey jealous well-well. I go ponish una shidren and shidren-shidren for di sin wey dia papa kommit, but I go show my mesi thru di kovenant to doz wey choose, obey and keep my kommand.
Explore Deutronomi 5:9-10
4
Deutronomi 5:8
Make una nor make any juju with anytin wey dey heaven; eart or for inside wota.
Explore Deutronomi 5:8
5
Deutronomi 5:7
Make una nor serve any oda god escept mi.
Explore Deutronomi 5:7
6
Deutronomi 5:11
Make una nor use di Oga una God name take make yeye, bikos God nor go sorry for anybody wey use en name anyhow.
Explore Deutronomi 5:11
7
Deutronomi 5:29
If to sey dem go just gri fear mi and obey all my kommand, e for dey well with dem and dia shidren-shidren forever.
Explore Deutronomi 5:29
8
Deutronomi 5:12
Una must obey di Sabat Day, just as di Oga una God kommand una.
Explore Deutronomi 5:12
9
Deutronomi 5:21
Make una nor dey like anoda pesin wife or husband, or sey yu like to take pesin house, land, savants, animal or any oda tin.”
Explore Deutronomi 5:21
10
Deutronomi 5:18
Make una nor sleep with who nor bi una husband or wife.
Explore Deutronomi 5:18
11
Deutronomi 5:20
Make una nor lie for pesin head.
Explore Deutronomi 5:20
12
Deutronomi 5:17
Make una nor kill.
Explore Deutronomi 5:17
13
Deutronomi 5:19
Make una nor tif.
Explore Deutronomi 5:19
14
Deutronomi 5:15
Remember sey una bi savant for Egypt and na di Oga una God take una komot der with en strong pawa. Na dis make God sey make una dey keep di Sabat Day.
Explore Deutronomi 5:15
15
Deutronomi 5:13-14
Una fit work and do evritin wey una won do for six days, but for di sevent day, una must nor do any work. Dis mean sey, both unasef, una shidren, una savants, una animals or di strenjas wey dey with una, evribody must rest for dat day.
Explore Deutronomi 5:13-14
16
Deutronomi 5:6
God sey, “Na mi bi di Oga wey bi una God, di One wey take una komot from Egypt where una for bi slave.
Explore Deutronomi 5:6
Home
Bible
Plans
Videos