Jenesis 42
42
Josef Brodas Go Egypt
1Wen Jakob hear sey food dey for Egypt, e kon tell en sons, “Wetin make una dey look each oda?” 2E sey, “Si, I hear sey food dey for Egypt. Make una go der go buy food, so dat honga nor go kill us.” 3So ten among Josef brodas kon go Egypt go buy food. 4But Jakob nor gri allow Benjamin, Josef broda follow dem, bikos e sey, “I nor wont make anytin happen to am.” 5So Israel shidren follow di oda pipol kon buy food for Egypt, bikos di honga strong well-well for Kanaan land.
6For dis time, na Josef dey rule di kountry and naim dey sell food give all di pipol. Wen en brodas kom meet am, dem bow face groun. 7Wen Josef si en brodas, na wons e know dem, but e do like sey e nor know dem kon dey shaut for dem. E ask dem, “Na where una from kom?”
Dem ansa, “Na from Kanaan land wi from kom buy food.”
8Josef know en brodas, but dem nor know am. 9Den Josef remember di dream wey e dream about dem, so e tell dem, “Una bi tif! Una kon look weda una fit attack awa land!”
10But dem ansa, “No o-o! My oga, na food yor savants just kom buy o-o! 11Na one papa all of us get o-o; wi bi good pipol o-o! Abeg, yor savants nor bi tif at-all.”
12But Josef sey, “Na lie, una kon si if una go fit attack awa land.”
13En brodas ansa, “Yor savants na from one house and wi bi twelf boys. Na one man for Kanaan born all of us. Di one wey yong pass dey with awa papa and one don die.”
14But Josef sey, “Just as I tell una before, na tif una bi! 15Na so I go take test una: As long as Fero dey alive, una nor go komot here until una bring una yonga broda kom here. 16One pesin among una go-go bring una broda kom, while di rest of una go stay here. Like dis, wi go know weda una dey tok trut. If not, as long as Fero dey alive, all of una na tif!”
17Josef keep dem for prison for three days. 18For di third day, Josef kon tell dem, “Make una do as I tok and una go dey alive, bikos I dey fear God. 19If una really dey good, make una leave one among una broda for here, so dat una go fit take food go give una family wey dey hongry for Kanaan. 20But una must bring una yonga broda kom meet mi. Den I go bilive una and una nor go die.” So Josef brodas do as e tok.
21Dem kon tell each oda, “Dem dey ponish us, bikos of awa broda Josef, bikos wi si en pain wen e dey kry make wi sorry for am, but wi nor gri listin to am. Na-im make all dis tins dey happen to us so!”
22Reuben kon tell dem, “I nor tell una sey make una nor sin against di boy, but una nor gri listin to mi? So naw, wi must pay for di sin wey wi kommit!”
23(Naw, dem nor know sey Josef dey undastand wetin dem dey tok, bikos e dey speak Egypt language and anoda pesin dey interpret am give en brodas.) 24So Josef turn from dem kon dey kry. Wen e turn face dem again, e kon sey make dem go put Simeon for prison as all of dem dey look.
Josef Brodas Go Back To Kanaan
25Den Josef orda sey make dem put food for dia bag kon put evribody money for dia bag back kon sey make dem help dem for dia journey. So en ofisas do as e tok. 26So dem kon put dia food for dia donkey kon go.
27Wen dem dey rest, one among dem open en sak make e give en donkey food and e kon si en money inside di sak. 28Den e tell en brodas, “Dem return my money give mi! E dey for inside my sak!” Dem sopraiz well-well kon turn face each oda with fear, den dem sey, “Na wetin God don do to us so?”
29Dem go back go meet dia papa Jakob for Kanaan kon tell am evritin wey happen dey sey, 30“Di man wey bi di oga for Egypt tok to us bad kon trit us like sey wi bi tif. 31But wi tell am sey, ‘Wi bi good pipol; wi nor kon spy or tif! 32Wi bi twelf brodas from one family and na one man born all of us. One don die and as wi dey tok, di yonga one dey with awa papa for Kanaan.’ 33Den di man wey bi di oga for di land kon tell us, ‘Na like dis I go take know if una dey good as una tok. Make una leave one among una brodas for here kon take food go give una family wey dey hongry for Kanaan. 34But una must bring una yonga broda kon meet mi, so dat I go know sey una dey good and una nor bi tif. Den I go give una broda back to una and una go fit waka as una like for dis land.’ ”
35As dem dey remove di food from dia sak, all of dem kon si dia money inside dia sak! As dem with dia papa si di money, dem kon dey fear. 36So dia papa Jakob kon tell dem, “Una won turn mi to who nor get pikin? Josef don die. I nor know wetin dey happen to Simeon naw. And naw una won kollect Benjamin too! Evritin just dey against mi.”
37Den Reuben tell en papa, “Make yu kill my two sons, if I nor bring Benjamin kom back kom meet yu. Make yu put am for my hand and I go bring am back.”
38But Jakob ansa, “Benjamin nor go follow una go anywhere, bikos en broda don die and na only en remain naw. If anytin happen to am wen una dey travel, den una go just make mi die with pain.”
දැනට තෝරාගෙන ඇත:
Jenesis 42: pcm
සළකුණු කරන්න
බෙදාගන්න
පිටපත් කරන්න

ඔබගේ සියලු උපාංග හරහා ඔබගේ සළකුණු කල පද වෙත ප්රවේශ වීමට අවශ්යද? ලියාපදිංචි වී නව ගිණුමක් සාදන්න හෝ ඔබගේ ගිණුමට ඔබගේ ගිණුමට පිවිසෙන්න
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee