Jenesis 36
36
Esau Shidren-shidren
1Dis na di shidren wey Esau (wey bi Edom) born. 2Esau marry from Kanaan and di woman name na Adah and na Elon wey kom from Hit bi en papa. E still marry Oholibama, wey bi Anah pikin and na Zibeon wey kom from Hiv, na en grand-papa. 3E still marry Basemat wey bi Nebaiot sista and na Ishmael bi dia papa. 4Adah born Elifaz for Esau and Basemat born Reuel. 5Oholibama born Jeush, Jalam and Korah. All dis na Esau sons wey dem born for Kanaan.
6Esau take en wifes, en shidren, evribody wey dey with am and en animals and evritin wey e get wey e buy from Kanaan kon go anoda land wey nor dey near en broda Jakob, 7bikos dia propaty too many and dem nor fit stay togeda, bikos di land wey dem dey, nor big rish. 8So Esau (wey still bi Edom) kon go stay for di hill for Seir.
9Dis story na about Esau, Edom pipol papa for di hill aria wey dey Seir.
10Dis na Esau sons name: Elifaz wey Esau wife Adah born; Reuel wey Esau wife Basemat, born. 11Elifaz sons na: Teman, Omar, Zefo, Gatam and Kenaz. 12Elifaz wey bi Esau pikin, en girl-friend Timna kon born Amalek for am. Dis na di sons wey Esau wife Adah, born.
13Reuel sons na: Nahat, Zera, Shammah and Mizzah. Na Esau wife Basemat born dis shidren.
14Esau wife Oholibama wey bi Anah pikin and Zibeon grand-pikin, na di sons wey e born for Esau bi dis: Jeush, Jalam and Korah.
15Di shiefs among Esau shidren; among en first-born Elifaz sons na: shief Teman, shief Omar, shief Zefo, shief Kenaz, 16shief Korah, shief Gatam and shief Amalek. Dis na di shiefs wey kom from Elifaz for Edom land and dem bi Adah sons.
17Reuel wey Esau born, na en sons bi dis: shief Nahat, shief Zera, shief Shammah and shief Mizzah. All dis na di shiefs wey kom from Reuel for Edom land and dem bi Basemat sons.
18Dis na di sons wey Esau wife Oholibama born: shief Jeush, shief Jalam and shief Korah. Na Esau wife Oholibama wey bi Anah pikin, born all dis shiefs.
19All dis na Esau (wey bi Edom) sons and dia shiefs.
Seir Shidren-shidren
20Seir wey kom from Horite na en sons for di land bi dis: Lotan, Shobal, Zibeon, Anah, 21Dishon, Ezer and Dishan. Dis na di shiefs from Horite wey bi Seir shidren-shidren for Edom land.
22Lotan sons na Hori and Homam; Lotan sista na Timna.
23Dis na Shobal sons: Alvan, Manahat, Ebal, Shefo and Onam.
24Na Zibeon sons bi dis: Aiaya and Anah (wey si di hot spring for di wildaness as e dey guide di animals wey bi en papa Zibeon own).
25Anah shidren na: Dishon and Oholibama wey bi Anah dota.
26Na Dishon sons bi dis: Hemdan, Eshban, Itran and Keran.
27Ezer sons na: Bilhan, Zaavan and Akan.
28Dishan sons na: Uz and Aran.
29Di shiefs for Horite na: shief Lotan, shief Shobal, shief Zibeon, shief Anah, 30shief Dishon, shief Ezer and shief Dishan. All dis na di shiefs for Horite akordin to di shief list for Seir land.
Edom Kings
31Dis na di kings wey rule for Edom land before any king rule for Israel:
32Beor pikin Bela, rule for Edom; di town name na Dinhabah.
33Wen Bela die, Jobab wey bi Zera wey kom form Bozrah kon rule for der.
34Wen Jobab die, Husham wey kom from Teman kon rule for der.
35Wen Husham die, Hadad wey bi Bedad pikin kon win Midian pipol for Moab land, den e rule for der. Di town name na Avit.
36Wen Hadad die, Samlah wey kom from Masrekah kon rule for der.
37Wen Samlah die, Shaul wey kom from Rehobot near di river kon rule too.
38Wen Shaul die, Baal-Hanan wey bi Akbor son kon rule for der.
39Wen Akbor pikin, Baal-Hanan die, Hadad kon rule for der; di town name na Pau. En wife name na Mehetabel wey bi Matred dota and Matred na Me-Zahab dota too.
40Dis na di shiefs name for Esau family, akordin to dia family, place and dia names. Dem bi: shief Timna, shief Alvah, shief Jetet, 41shief Oholibama, shief Elah, shief Pinon, 42shief Kenaz, shief Teman, shief Mibzar, 43shief Magdiel and shief Iram. All dis na di shiefs for Edom, akordin to where dem stay for di land wey dem kollect. Esau wey bi Edom pipol papa, na en story bi dis.
දැනට තෝරාගෙන ඇත:
Jenesis 36: pcm
සළකුණු කරන්න
බෙදාගන්න
පිටපත් කරන්න

ඔබගේ සියලු උපාංග හරහා ඔබගේ සළකුණු කල පද වෙත ප්රවේශ වීමට අවශ්යද? ලියාපදිංචි වී නව ගිණුමක් සාදන්න හෝ ඔබගේ ගිණුමට ඔබගේ ගිණුමට පිවිසෙන්න
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee