Jenesis 3
3
How Man Take Sin
1Na snake play wayo pass any wiked animal wey God kreate. So di snake tell di woman, “Na true sey God sey, ‘Make una nor chop from all di tree wey dey di gardin’?”
2Di woman ansa, “No o-o! Wi fit chop from all di fruit wey dey di gardin; 3but about di fruit from di tree wey dey di gardin centre, God sey, ‘Una must nor chop or tosh am, bikos if una chop or tosh am, una go die.’ ”
4So, di snake tell di woman, “True-true, una nor go die, 5bikos God know sey wen una chop from di tree, una eyes go open and una go bi like God ensef, wey know wetin dey good or bad.”
6Wen di woman si sey di fruit wey di tree dey produce fine well-well and e good to chop; and e go make pesin get sense well-well, e kon take some of di fruit chop. Di woman still give some to en husband wey dey with am and e kon chop too. 7Den dem two eye kon open and dem kon know sey dem nor wear anytin; so dem sew fig leaf togeda kon take am kover dia body.
God Judge Dem
8Den di man and en wife kon dey hear Oga God dey waka for di gardin wen evriwhere don kwayet for evening, so dem kon hide from di Oga wey bi dia God. 9But God koll di man kon sey, “Where yu dey?”
10Di man ansa, “I hear wen Yu dey waka for di gardin and fear kon katch mi, bikos I nor wear anytin, so I kon hide.”
11So Oga God ask am, “Na who tell yu sey yu dey naked? Abi, yu don chop di fruit for di tree wey I sey make yu nor chop?”
12Di man ansa, “Di woman wey Yu give mi bring some fruits from di tree and I kon chop am.”
13Den Oga God tell di woman. “Wetin bi dis wey yu don do so?”
Di woman ansa, “Di snake deceive mi and I kon chop from am.”
14God kon tell di snake, “Bikos yu do like dis,
“For all di wild animals wey I kreate for dis eart,
curse dey yor head!
Na belle yu go take dey waka
and na san-san yu go dey chop
for all yor life.
15I go make yu hate woman
and yor pikin go still hate pikin
wey woman born.
Pikin wey woman born go mash yor head
and yu go bite dia leg.”
16God kon tell di woman,
“Wen yu dey labor, I go make am pain yu well-well.
Na inside pain yu go take born shidren.
Yu go won kontrol yor husband,
but na-im go bi yor head.”
17God tell Adam, “Yu obey yor wife kon chop from di tree wey I kommand yu sey, ‘Make yu nor chop from.’
“Bikos yu do dis, I curse di groun.
Yu go work hard to make di groun bring food
till yu die.
18E go dey bring out grass for yu,
but na di korn from di groun na-im yu nid as food.
19Yu go sweat before yu chop,
until di day wey
yu go die go back to groun,
where I from kreate yu.”
20Di man kon koll en wife Eve, bikos na en bi mama to evritin wey dey alive.
God Porshu Adam And Eve
21God use skin take make garment for Adam and en wife kon give dem make dem wear. 22So God sey, “Naw wen man don bi like us, wen e don know wetin dey good and bad, make wi nor let am chop from di tree wey dey give life, if not, e nor go ever die.” 23So Oga God kon porshu man and en wife komot from Eden Gardin, so dat e go-go farm for di groun where God from kreate am. 24Wen God porshu dem komot, E kon put angels for di gate for di east side for di gardin with one swod wey dey bring fire and e dey turn face evriwhere. Dis one na to stop anybody wey won go near di tree wey dey give life.
Atualmente Selecionado:
Jenesis 3: pcm
Destaque
Compartilhar
Copiar
Quer salvar seus destaques em todos os seus dispositivos? Cadastre-se ou faça o login
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee