YouVersion logotips
Meklēt ikonu

Jenesis 7

7
Di Rain
1So Oga God tell Noah, “Make una enter di boat, yu and yor family, bikos I si sey yu nor get fault among evribody for dis yor generashon. 2Yu must karry seven man and seven woman for evry klean animal follow body, but for evry animal wey nor dey klean, yu go take only one man and one woman. 3Den yu go still take seven man and seven woman from evry kind bird wey dey fly for sky, so dat dem go born many shidren leta. 4Bikos seven days from naw, I go send rain kom di eart for forty days and forty nite kon kill evritin wey get life wey I kreate.”
5So Noah do as God kommand am. 6Noah don rish six hundred years wen wota kover di eart. 7Noah enter di boat with en sons, en wife and en shidren wife dem wen di rain won fall. 8Two-two from evry klean animal; animals wey nor klean; birds and evritin wey dey creep for groun, 9both man and woman, all enter di boat kom meet Noah, just as God kommand am. 10And afta seven days, di rain kon start to fall.
11Wen Noah don old rish six hundred and two monts, for di seventint day for di mont, all di wota for sky bigin rush anyhow and di heaven kon open, 12den rain from heaven kon start to fall for di eart for forty days and forty nites. 13For dat very day, Noah enter di boat with en sons Shem, Ham and Jafet, plus en wife and en shidren wife. 14Dem enter with evry kind tin wey get life; difren animal; evritin wey dey creep for groun akordin to how dem bi and evry bird akordin to how dem bi, plus evritin wey get feada. 15Two-two from evritin wey get life kom meet Noah inside di boat. 16Doz wey enter na man and woman, just as God kommand am. Den Oga God klose di boat door.
17Di wota fall for di eart for forty days. As di wota dey many, di boat dey go up. 18Di wota kover di eart and di boat kon dey float on-top di wota. 19Di wota kon kover di eart sotey e even kover di mountins wey high pass for di eart. 20Di wota kon high rish twenty fit afta e don kover di mountins wey high pass. 21And evritin wey get life for di eart kon die: di bird for sky, animals, both di ones for house and wiked ones; evritin wey dey di eart and all human being. 22Evritin for land wey dey breath thru dia nose kon die. 23So Oga God distroy evritin wey get life for di eart: pipol, animals, di ones wey dey creep for groun and birds for di sky. All of dem die komot di eart. Only Noah and doz wey dey with am for di boat, naim save. 24Di wota kover di eart for one hundred and fifty days.

Pašlaik izvēlēts:

Jenesis 7: pcm

Izceltais

Dalīties

Kopēt

None

Vai vēlies, lai tevis izceltie teksti tiktu saglabāti visās tavās ierīcēs? Reģistrējieties vai pierakstieties