1
Jenesis 14:20
Holy Bible Nigerian Pidgin English
Make all praiz bi di Most High God own, di one wey diliver yor enemies put for yor hand.” Abram kon give Melkizedek one out of evry ten tin wey e bring kom back from di war.
Compara
Explorar Jenesis 14:20
2
Jenesis 14:18-19
Melkizedek wey bi Salem king kon bring wine and bread kom out. (Dis Melkizedek na di Most High God priest.) E bless Abram kon sey, “Make di Most High God bless Abram, di God wey kreate heaven and eart.
Explorar Jenesis 14:18-19
3
Jenesis 14:22-23
But Abram ansa, “I raiz my hand to di Oga God, di Most High God wey kreate heaven and eart and I promise sey I nor go take anytin wey bi yor own. Nor bi even yor rope or sandal. So dat yu nor go sey, ‘Na mi make Abram get money.’
Explorar Jenesis 14:22-23
Inici
La Bíblia
Plans
Vídeos