Matiu 8
8
Jesus Heal One Leper
1Afta Jesus kom down from di mountin, plenty pipol kon follow am. 2One leper kon meet am, knee down for en front, kon sey, “Oga God, if yu wont, yu go fit heal mi, so dat my body go well.”
3Jesus tosh di man kon sey, “Yes, I wont make yu well!” At wons, di sickness komot from di man body. 4Den, Jesus tell am, “Nor tell anybody, but go meet di priest, make e look yu. Afta, go give di ofrin wey Moses kommand to show sey yu don well.”
Jesus Heal Roman Offisa Savant
5Wen Jesus enter Kapanaum, one Roman offisa kon meet am dey beg make e help am. 6Di offisa sey, “Oga God, my savant nor well for house, e nor fit get up and body dey pain am well-well.”
7Jesus kon ansa, “I go kom heal am.”
8But di offisa sey, “Oga God, I nor big rish who yu go enter en house, instead just tok and my savant go well. 9Misef, I bi man wey get oga and I still get sojas wey dey under mi. If I kommand one sey make e ‘Go’, e go-go, if I kommand anoda one sey make e ‘Kom’, e go kom and if I kommand my savant make e ‘Do dis tin’, e go do am.”
10Wen Jesus hear wetin e tok, e sopraiz, den e tell di pipol wey dey follow am, “I tell una true word, I neva si anybody wey get dis kind faith for Israel! 11Many pipol from east and west go kom follow Abraham, Isaak and Jakob chop inside God Kingdom. 12But dem go trow di pipol wey suppose enter di Kingdom for darkness, where dem go dey kry and grind dia tit.”
13Den Jesus tell di offisa, “Go, since yu bilive, na so e go bi for yu.” Na dat same time di savant well.
Jesus Heal Pita Wife Mama
14Wen Jesus enter Pita house, e kon si sey Pita wife mama nor well. 15Den e tosh di woman and di fever komot from en body. So, di woman get up kon bigin serve dem.
16Wen evening rish, dem karry many pipol wey demon dey inside dem kom meet Jesus. E drive di wiked spirits komot kon heal all di pipol wey nor well. 17Dis one make wetin Profet Isaya tok bi true,
“E remove awa sickness
and karry awa diziz komot.”
Jesus Ansa Pipol Wey One Follow Am
18Wen Jesus si plenty pipol gada am, e kon kommand en disciples make dem cross go di oda side for di river. 19One law tish kon tell Jesus, “Tisha, I go follow yu go anywhere wey yu dey go.”
20Jesus ansa am, “Rabbit and bird get dia own house, but Man Pikin nor get where e go fit rest en head.”
21Anoda disciple kon sey, “Oga God, make I first go beri my papa.”
22Jesus ansa am, “Follow mi, make doz wey don die beri dia dead body.”
Jesus Stop Heavy Breeze For Sea
23As Jesus enter di boat, en disciples kon follow am. 24At wons, strong breeze kon dey blow for di sea and wave won sink di boat. But Jesus Christ dey sleep. 25So en disciples wake am kon sey, “Oga God, save us! Na die wi dey so o-o!”
26Jesus ansa dem, “Una faith small o-o. Wetin make una dey fear?” Den e get up, kommand di breeze and di wave sey, make dem stop and evriwhere kon kwayet at wons.
27Di men sopraiz well-well kon dey ask each oda, “Wish kind man bi dis sef? Even breeze and wave dey obey am!”
Jesus Heal Men Wey Get Demon
28Wen Jesus rish di oda side where Gadarenes pipol dey stay, two men wey get demon, run from di beri groun kom meet am. Nobody dey fit pass dat road, bikos di men wiked well-well. 29Di demons kon hala, “God Pikin, make yu leave us o-o, abi yu kom sofa us wen time neva rish?”
30For where dem dey, plenty pig dey chop near der. 31Den di demons beg Jesus, “If yu drive us komot, make yu send us go enter inside di pigs.”
32So Jesus tell dem, “Make una go!” At wons, dem kon komot enter inside di pigs and all di pigs rush go enter di river kon die. 33Di pipol wey dey look di pigs, run go di town kon tell pipol evritin wey happen to di men wey get demons. 34Den evribody for di town kon dey find Jesus. Wen dem si am, dem kon beg am make e komot from dia aria.
Currently Selected:
Matiu 8: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee