YouVersion Logo
Search Icon

Matiu 3

3
John Di Baptist Message
1For dat time, John di Baptist dey prish inside wildaness for Judea sey, 2“Make una turn from sin kom meet God, bikos God Kingdom don near.” 3Na dis John Profet Isaya tok about sey,
“One pesin dey shaut inside wildaness sey,
‘Make una make God road strait.’ ”
4John wear klot wey dem use kamel hair make, e use leda belt tie waist and na lokust and honey for bush, e dey chop. 5Pipol from Jerusalem, Judea and all di town wey dey near Jordan River dey run go meet am 6and e kon baptize dem inside Jordan River, afta dem konfess dia sins.
7But wen e si many Farisee and Sadusi pipol dey kom make e baptize dem, e kon tell dem, “Una, snake shidren! Who warn una about God judgement wey dey kom? 8Naw, make una do wetin go show sey una don turn from sin kom meet God, 9make una nor tink sey una don free bikos una sey, ‘Abraham na awa papa.’ Make I tell una, God fit turn all dis stone to Abraham shidren! 10Naw sef, dem don put di axe for di tree bottom and any tree wey nor bear betta fruit, dem go kut am trow inside fire.
11“I dey baptize una with wota make una for turn from sin kom meet God, but di pesin wey go kom afta, strong pass mi. I nor big rish to luz di rope wey dey en shoe, na-im go baptize una with Holy Spirit and fire. 12Di fan wey e go take blow kanda komot from korn, dey en hand and e go gada and keep en korn inside store kon burn di dirty for faya wey nor dey kwensh.”
John Baptize Jesus Christ
13Jesus kom from Galilee make John for baptize am for Jordan River. 14But John won kon stop am sey, “Na yu suppose baptize mi, instead yu kom meet mi make I baptize yu?”
15Jesus ansa, “Make e bi so naw, e betta make wi do evritin wey God wont.” So, John kon baptize am.
16As Jesus dey kom out from di wota afta John don baptize am, heaven open and John kon si God Spirit wey bi like dove, stay on-top Jesus head. 17Naim one vois from heaven kon sey, “Dis na My pikin wey I love and e dey make belle sweet mi.”

Currently Selected:

Matiu 3: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in