YouVersion Logo
Search Icon

Jenesis 8

8
Di Rain Stop
1But God remember Noah and all di animals wey dey inside di boat. So E make one breeze blow for di eart, den di wota kon dey dry small-small. 2Di rivers for heaven klose and di rain kon stop to fall from di sky. 3Di wota kon dey dry small-small, so afta one hundred and fifty days, dry groun kon show. 4For di seventint day for di seven mont, di boat kon stay on-top one mountin wey dem dey koll Ararat. 5Di wota still dey go down until di tent mont and dem kon dey si top of di mountin.
6Afta forty days, Noah open di window wey e make for di boat 7kon send one bird go; di bird fly dey go front and back, until di wota kon dry finish. 8Den Noah send anoda bird make e go si if di wota don dry finish. 9Di dove nor si anywhere pesh put, bikos wota still kover di eart, so e kom meet Noah back for di boat. 10Noah wait for anoda seven days, den e send di dove go again. 11Wen di dove kom back for evening, betta fresh olive tree leaf dey en mout! Noah kon know sey di wota don almost dry finish. 12E wait for anoda seven days, den e send di dove go again, but dis time, di dove nor kom back.
13Wen Noah don rish six hundred and one year, for di first day for di first mont, di wota kon dry finish from di eart and Noah open di boat kon si sey di groun don dry. 14So for di twenty-seven day for di sekond mont, di eart kon dry finish. 15Den God tell Noah, 16“Make una kom out from di boat, both yu, yor wife, yor shidren and dia wife. 17Make all di tins wey get life kom out with yu. Make evritin kom out: di birds, animals and evritin wey dey creep for groun. Make dem get belle kon born full di eart!” 18Noah kom out with en sons, wife and en pikin wife dem. 19Evritin wey get life: animals, birds and di ones wey dey creep kon kom out one-by-one.
Noah Sakrifice
20Noah build one altar for Oga God. E kon take some from evry klean animal and bird take offa ofrin for di altar. 21Di ofrin smell kon make belle sweet God, so E tell ensef, “I nor go ever curse di eart again, bikos of wetin human being do; even doh I know sey since wen I kreate dem, na only bad tins dem dey tink. I nor go ever distroy evritin wey get life as I don do so.
22“As long as di eart dey,
time go dey to plant and time go dey to plok wetin dem plant.
Sometaims kold go dey and oda times heat go dey.
Rain go fall sometaims and oda times evriwhere go dry,
but day and nite go always dey.”

Currently Selected:

Jenesis 8: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in