Jenesis 31
31
Jakob Run From Laban
1Jakob kon hear sey, Laban shidren dey sey, “Jakob don take evritin wey bi awa papa own and naw, e don get money well-well.” 2So Jakob kon si sey Laban nor dey do as e dey do with am before.
3Den God tell Jakob, “Make yu go back to yor papa and yor family and I go dey with yu.”
4So Jakob sey make dem koll Rashel and Leah kom meet am for di field 5and e tell dem, “E klear sey una papa nor like mi again. But di God wey bi my papa God always dey with mi. 6Una know sey I don serve una papa with all my mind and pawa, 7yet una papa wont shit and short-pay mi. But God nor gri make una papa wound mi. 8If una papa sey, ‘Di animals wey get spot go bi yor pay,’ dat mean sey all di animal wey dem born with spot for body go bi my own and if una papa sey, ‘Di one wey get mark go bi yor pay,’ den all di animals wey dem born with mark for dia body, go bi my own too. 9Like dis, God don give mi many of una papa animals. 10For di time wen animals dey sleep with each oda, I look kon si for dream sey di goats wey dey sleep with di oda animals, get mark, spot and dem dey black. 11Den God angel tell mi for di dream, ‘Jakob,’ so I ansa, ‘Na mi bi dis!’ 12Di angel sey, ‘Make yu si and know sey, all di goats wey sleep with di oda animals, get spot, mark and dem black, bikos I don si evritin wey Laban dey do yu. 13Bikos na mi bi di God wey dey for Bethel, di place where yu for anoint stone kon make vow. Naw, make yu get up komot from dis land, den go back go meet yor pipol.’ ”
14Den Rashel and Leah ansa, “E still get anytin wey remain for us for awa papa house? 15E nor dey trit us like strenjas naw? Bikos e don sell us and e don really chop di money. 16All di money and propaty wey God don take from awa papa hand, na wi and awa shidren get dem.”
17So Jakob kon put en wife and shidren on-top kamel. 18E karry all en animals, all en propaty wey e don get, di animals wey e buy for Paddan Aram den e kon dey go Kanaan Land go meet en papa Isaak. 19As Laban go kare for en sheep, Rashel kon tif en papa gods for di house. 20Jakob deceive Laban di Aramean, bikos e nor tell dem sey e won go. 21E go with evritin wey e get. E cross Eufrates River den e kon face di hill kountries for Gilead.
Laban Porshu Jakob
22Wen dem tell Laban for di third day sey Jakob don run, 23e take en men with am kon porshu Jakob for seven days. E katch am for di hill kountries for Gilead. 24But God kom meet Laban for dream for nite kon tell am, “Make yu mind wetin yu go tell Jakob, weda e dey good or bad.”
25Laban meet Jakob for where e dey. Naw Jakob don build tent for di hill and Laban and en men still build tent for dat aria too. 26So Laban tell Jakob, “Wetin make yu just deceive mi kon karry my dotas dey go like pipol wey dem katch with swod? 27Why yu play wayo run kon deceive mi? But yu for tell mi, so dat I go free yu with good mind kon play instrument and sing betta song for yu. 28Why yu nor allow mi tell my grand-shidren and dotas bye-bye? Si, wetin yu do so, nor dey good at-all. 29If I won wound yu, I go fit do am. But yor papa God tell mi yestiday nite for dream sey, ‘Make yu mind wetin yu go tell Jakob, weda e dey good or bad.’ 30And naw yu just dey go, bikos e don tey wey yu dey won go yor papa house, but wetin make yu tif my gods?”
31Jakob ansa Laban, “Na fear kause am, bikos I tink sey yu go take yor shidren from mi with force. 32But anybody hand wey yu for si yor gods, go die. For all dis men present make yu point di tin wey I karry wey bi yor own, den make yu take am.” Naw Jakob nor know sey na Rashel tif di gods.
33So Laban enter Jakob room and Leah room with di two savant own, but e nor si anytin. Den e komot from Leah room kon enter Rashel own. 34Naw, Rashel don take di gods kon put dem for kamel den e sidan put. Laban look evriwhere for di tent, but e nor si dem. 35Den Rashel tell en papa, “Make my oga nor vex sey I nor fit stand, bikos I dey si my period.” So e look evriwhere and e nor si di gods.
36Den Jakob kon dey vex well-well for Laban sey, “Na wetin I do? Na wish sin I kommit wey make yu porshu mi like dis? 37Yu don shek evritin wey I get; wetin yu don si wey bi yor own? Make yu bring am kom out before my men and yor men, so dat dem go tok put for dis matter.
38“I don dey with yu for twenty years naw. Yor animals wey get belle dey always born and I neva for one day chop one among yor animals. 39Anytin wey wiked animal chop, I nor dey bring dem kom meet yu, I dey karry di cross by mysef. Yu dey ask of am from my hand, weda dem tif am for nite or day time. 40Na der I dey-dey: for day time, di sun dey waya mi and for nite, kold dey won kill mi and sleep dey komot my eyes. 41For dis twenty years wen I dey for yor house. I serve yu for fourteen years for yor two dotas and six years for di animals, but yu still dey short-pay mi anyhow. 42If my papa God, Abraham God and di Pesin wey Isaak dey fear nor dey with mi, true-true yu for porshu mi go without anytin. God si my mind and di work wey I dey do with my hand, naim make am tok to yu yestiday nite.”
Jakob Agri With Laban
43Den Laban ansa Jakob, “Di girls na my pikin, di shidren na my shidren, di animals na my animals and evritin wey yu dey si so, na my own. But wetin go make mi ponish my dotas and di shidren wey dem born? 44So make yu kom make wi enter agriment; dat is yu and mi. And dat one go show sey wi don setol.”
45So Jakob take one stone kon set am as pila for der. 46Den Jakob tell en men, “Make una gada stones.” And dem gada many stones wey high like mountin den dem kon chop for der. 47Laban koll am Jegar-Sahaduta, but Jakob koll am Galeed.
48Laban kon sey, “Dis stones na witness between yu and mi today.” Dat na why dem koll am Galeed 49and Mizpa, bikos e sey, “Make di Oga God dey wosh mi and yu, even wen wi nor dey togeda again.
50“If yu opress my dotas or if yu marry anoda wife follow my dotas, aldo nobody dey to si us, but God na awa witness.” 51Den Laban tell Jakob, “Si dis stones and di pila wey wi build between us. 52Na dem go bi witness and I nor go ever pass di stones kom meet yu and yu too nor go ever pass kom meet mi, bikos yu won kon fight mi. 53Abraham and Nahor God, dia grand-papa God go judge between yu and mi.”
So Jakob kon swear with di God wey en papa Isaak dey fear 54and Jakob offa sakrifice for di hill kon koll en men kom chop bread. Dem chop bread kon sleep for di hill dat nite. 55Very early for di next morning, Laban wake-up kon kiss en grand-shidren and en dotas, den e bless dem. Den Laban kon go en house.
Currently Selected:
Jenesis 31: pcm
Highlight
Share
Copy
![None](/_next/image?url=https%3A%2F%2Fimageproxy.youversionapi.com%2F58%2Fhttps%3A%2F%2Fweb-assets.youversion.com%2Fapp-icons%2Fen.png&w=128&q=75)
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee