Jenesis 30
30
1Wen Rashel si sey e nor fit born shidren for en husband, e kon dey jealous Leah, en sista. Den e tell Jakob, “Make yu give mi shidren or I go die!”
2Jakob kon dey vex with Rashel so e sey, “Na mi bi God wey neva give yu pikin?”
3Rashel ansa, “I wont make yu sleep with my savant Bilhah, so dat e go born shidren for mi and I go kon get my own family thru am.” 4So Rashel give en savant Bilhah to Jakob and Jakob kon sleep with am. 5Bilhah get belle kon born boy pikin for Jakob. 6Den Rashel sey, “God don save mi. E don ansa my prayers kon give mi boy pikin.” Dat na why Rashel koll di pikin Dan. 7Rashel savant Bilhah kon get belle again for Jakob and e still born boy. 8Den Rashel sey, “I don really fight betta fight with Leah, my sista and I don win.” So e koll di pikin Naftali.
9Wen Leah si sey e nor fit born again, e kon give en savant Zilpah to Jakob. 10E nor too tey before Leah savant Zilpah born boy for Jakob. 11Leah kon sey, “E good well-well!” So e koll di pikin Gad. 12Den Leah savant Zilpah born anoda pikin for Jakob. 13Leah kon sey, “My belle dey sweet mi, bikos wimen go dey happy well-well, bikos of mi!” So e koll di pikin Asher.
14So wen dem dey do di wheat feast, Reuben komot kon si some mandrake plants for di field, den e bring dem kon give en mama Leah. Rashel kon tell en sista Leah, “Make yu give mi some for di plant wey yor pikin bring.” 15But Leah ansa, “So my husband wey yu take neva do yu? Yu won still take my pikin mandrake too?”
Rashel ansa, “Okay, make yu give mi some mandrake and e go sleep with yu dis nite.”
16Wen Jakob kom back from di field dat evening, Leah go meet am kon sey, “Yu must sleep with mi today o-o, bikos I don pay to get yu with my pikin mandrake.” So Jakob sleep with am dat nite. 17God hear Leah prayer; so e kon get belle and e born anoda boy for Jakob for di fift time. 18Den Leah sey, “God don give mi my reward, bikos I give my savant to my husband make e sleep with am.” So e koll am Issakar. 19Leah get belle again and e born di nomba six boy. 20Den Leah sey, “God don give mi betta gift. Naw, my husband go honor mi, bikos I don born six boys for am.” So e kon am Zebulun. 21Afta, Leah born one girl kon koll am Dinah.
22Den God sorry for Rashel. E hear en prayer kon make am get belle. 23Rashel get belle kon born boy. Den Rashel sey, “God don take my shame komot.” 24E kon koll am Josef wey mean, “Make God give mi anoda boy pikin.”
Jakob Animals
25Afta Rashel don born Josef, Jakob kon tell Laban, “Make yu let mi go house go meet my own pipol for my own kountry. 26Make I take my wifes and my shidren follow body, bikos I don work for yu.”
27But Laban sey, “If really sey I dey good to yu, den yu go stay with mi, bikos my spirit tell mi sey, God bless mi, bikos of yu.” 28Laban still tell Jakob, “Make yu just tell mi wetin I go pay and I go pay yu.”
29Jakob ansa, “Yu know as I don work for yu and how I don kare for yor animals. 30True-true, dem nor many wen I kom, but naw, wetin yu get don plenty well-well. God don bless yu for evriwhere wey I for work for yu. But naw, how long e go take before I go do sometin for my own family?”
31So Laban ask, “Wetin yu wont make I give yu?”
Jakob ansa, “Yu nor nid to give mi anytin, but if yu gri with dis one tin, I go kontinue to kare and guide yor animals: 32Make yu let mi waka round all yor animal kon komot di ones wey get spot or mark or wey black. Dis animals go bi my pay. 33Den my good go tok for mi leta, wen yu go si sey na only di ones wey yu give mi I take. If yu si any animal wey nor get mark, or spot or black, den make yu koll mi tif.”
34Laban kon sey, “I gri! Make e bi as yu tok.” 35So dat day, Laban komot all di animals wey get white spot, mark or wey black kon sey make en pikin kare for dem. 36Den e separate dem from Jakob own with three days journey and Jakob kon dey kare for di oda animals.
37But Jakob take fresh branches wey dem just kut from poplar, almond and plane tree kon peel dem until e si di white wood for inside. 38Den e put di tree wood for di wota where di animals for dey drink. E put dem for di animals front wen dem dey chop and dem kon drink di wota. 39Den wen di sheep dem sleep togeda for di branches front, dem kon dey born pikin wey get mark, spot and black. 40Jakob kon separate doz animal from Laban own. Den wen di animals won sleep with each oda again, e kon turn dem face Laban own wey nor get spot and black. So e kon get animal for ensef and e nor mix dem with Laban own. 41Wen di strong animals wey bi woman won sleep with man animal, Jakob go put di branches for wota, so dat dem go sleep togeda near di branches. 42But if di animals dey weak, e nor go put di branches for dia front. Like dis, na Laban kon get all di weak animals and Jakob kon get di ones wey dey strong. 43Like dis, Jakob kon get money, animals, both man and woman savant, kamel, donkey and plenty propaty.
Currently Selected:
Jenesis 30: pcm
Highlight
Share
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee