Jenesis 26
26
Isaak Stay Gerar
1Honga kon dey di land, just as e happen for Abraham time. So Isaak kon go Gerar where Abimelek wey bi Filistia pipol king dey stay. 2God appear to Isaak kon tell am, “Make yu nor go Egypt; but make yu stay for di land wey I go show yu. 3Stay for dis land. Den I go dey with yu kon bless yu, bikos I go give all dis land to yu and yor shidren-shidren. I go do wetin I promise yor papa Abraham. 4I go make yor shidren plenty like di stars wey dey di sky and I go give dem all dis land. I go bless all di nashon for di world with yor shidren-shidren name. 5All dis tins go happen, bikos Abraham obey mi kon keep all my words; my kommand, my rules and my laws.” 6So Isaak kon stay for Gerar. 7Wen di men for di place ask am about en wife, e kon tell dem sey, “Na my sista.” Fear nor fit let am sey, “Na my wife,” bikos e tink for en mind sey, “If I sey na my wife, di men for dis place go kill mi make dem for fit get Rebekah, bikos e too fine.” 8Afta Isaak don stay der tey, Abimelek wey bi Filistia pipol king kon look from window and e si Isaak dey play with en wife Rebekah.
9So Abimelek koll Isaak kon sey, “Dis woman na yor wife! Wetin make yu sey, ‘Na my sista e bi?’ ”
Isaak ansa, “Na bikos I tink sey somebody fit kill mi just to get am.”
10Den di king sey, “Wetin make yu do us like dis? Wot of if one of my men kon go sleep with yor wife? Den yu for don make us sin!” 11So Abimelek kommand all en pipol sey, “Anybody wey tosh dis man or en wife, must die.”
12Isaak harvest plenty well-well and e rish hundred times of wetin e plant dat same year, bikos God don bless am. 13Isaak kon rish well-well. E dey prosper more-more until evribody know am. 14E get many sheep and kattle and en savant many well-well, so Filistia pipol kon dey jealous am. 15So Filistia pipol karry san-san kon kover all di well wey Isaak papa savants, dig for di time wey Abraham dey der.
16Den Abimelek kon tell Isaak, “Make yu komot from here go anoda place, bikos di pawa wey yu get, don strong pass awa own.”
17So Isaak komot der kon go stay for Gerar Valley. 18Isaak kon open di well again wey en papa Abraham dig wey Filistia pipol kover afta Abraham don die. Isaak give dis well di same name wey en papa gi-am before. 19Wen Isaak savant dig for di valley kon si well wey get fresh wota, 20di men for Gerar kworel with Isaak men kon dey sey, “Na wi get di wota!” So Isaak koll di well Esek, bikos dem follow am drag am.
21En savants dig anoda well, but dem still follow am drag am too, so Isaak koll di well, Sitnah. 22Den e komot from der kon go dig anoda well. Nobody follow am kworel for dis one, so Isaak kon koll am Rehobot dey sey, “Naw Oga God don make room for us and wi go prosper for dis land.”
23From der, Isaak kon go Beersheba. 24God appear to am dat nite kon sey, “Na mi bi yor papa Abraham God. Make yu nor fear, bikos I dey with yu. Bikos of my savant Abraham, I go bless yu kon make yor shidren-shidren plenty.” 25Den Isaak build one altar for der kon woship God. E put en tent for der and en savant kon dig anoda well.
Isaak Agri With Abimelek
26Naw, King Abimelek don kom visit am from Gerar with en friend Ahuzzat and Fikol wey bi di sojas oga. 27Isaak kon ask dem, “Wetin make una kom meet mi? Nor bi bikos una hate mi, naim make una porshu mi?”
28Dem ansa, “E klear sey God dey with yu. So wi kon sey, make peace dey between us: dat is between wi and yu. Make yu allow us make peace with yu, 29so dat yu nor go ponish us, just as wi nor ponish yu, but wi dey always trit yu well, before wi even porshu yu with peace. Naw God don bless yu.”
30So Isaak do party for dem kon celebrate. 31Very early for di next morning, Isaak and King Abimelek kon make peace with each oda. Isaak kon escort dem and dem kon komot without wahala. 32Dat day, Isaak savant kon tell Isaak about di well wey dem dig sey, “Wi don si wota.” 33So Isaak koll di well Shibah; dat na why dem dey koll di town till today, Beersheba.
Esau And En Strenj Wifes
34Wen Esau don rish forty years, e kon marry Judit wey bi Beeri pikin and Beeri kom from Hit. E still marry Basemat wey bi Elon wey Het pikin born. 35Di matter nor kon make Isaak and Rebekah, happy.
Currently Selected:
Jenesis 26: pcm
Highlight
Share
Copy
![None](/_next/image?url=https%3A%2F%2Fimageproxy.youversionapi.com%2F58%2Fhttps%3A%2F%2Fweb-assets.youversion.com%2Fapp-icons%2Fen.png&w=128&q=75)
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee