Deutronomi 1
1
Introdushon
1Dis na wetin Moses tell Israel pipol for di wildaness for Jordan River near Arabah opposite Suf, between Paran and Tofell, Laban, Hazerot and Dizahab. 2Na eleven days journey e suppose bi from Horeb to Kadesh Barnea wen dem pass thru Mount Seir.
3Forty years afta Israel pipol don komot Egypt, for di first day for di elevent mont, Moses kon tell Israel pipol evritin wey God kommand am. 4Dis tin happen for Edrei, afta dem win King Sihon for Amor, wey en soja oga na Heshbon and King Og for Bashan wey en sojas oga na Ashtarot.
5So, wen Israel pipol dey for Moab land wey dey Jordan River, na der Moses for tell dem dis law:
Wetin Happen For Horeb
6Oga God tok to us for Horeb sey, “Una don too tey for dis mountin. 7So make una get up kon kontinue una journey go Amor kountries for di hill; all di arias wey dey near der, di high lands, di Shefelah, di Negev, all di lowland, Kanaan and Lebanon, still e rish di great River Eufrates. 8Look! I don already give di land to una. So make una go kollect di land wey mi God promise to give una grand-grand papa Abraham, Isaak, Jakob and dia shidren.”
9Moses still sey, “For dat time, I sey, ‘Una wahala too mush for only mi. 10God don make una many well-well like stars for sky! 11So make God wey bi una grand-grand papa God bless una well-well, just as E promise! 12But una wahala too mush to bear! How I wont take handle all una wahala and trobols? 13Make una choose some men from each tribe wey wise, get wisdom and I go make dem una leaders.’
14“Den una sey, ‘Wetin yu tell us so, dey good well-well.’
15“So I take di men wey una selet by unasef kon make dem judge and ofisas ova una. Some dey lead 1,000 pipol, some hundred, some fifty, while some na only ten pipol. 16For dat time, I tell di judge dem sey, ‘Una must listin to una pipol and doz wey bi strenjas, den make una judge well. 17Make una nor favor anybody and na as una take listin to rish man kase, na so too una go take listin to poor man own. Make una nor fear anybody, bikos na God dey judge evribody. Any kase wey una nor fit judge, make una bring am kom meet mi.’ ”
Message For Kadesh Barnea
18For dat time, I kommand una about all di tins wey una go do. 19Den just as God kommand us, wi komot from Mount Horeb kon travel pass di great wildaness wey dey make pesin fear, just as unasef go remember, den wi face Amor pipol kountries. Wen wi rish Kadesh Barnea, 20I kon sey, “At last wi don rish Amor pipol kountry wey di Oga awa God don give us. 21Si! E don put di land for una front. So make una go take am, just as God promise una. Make una nor fear anytin! Make una heart strong!
22“So all of una waka kom meet mi sey, ‘Make wi first send some men go si di land, so dat dem go kom back kon tell us as e bi. Dem go tell us di best way or town wey wi go take enter and attack di kountry.’
23“I tink sey wetin una tok dey good, so I kon choose twelf men, one form each tribes. 24Dem go di hill kountry until dem rish Eshkol Valley kon look am well-well. 25Dem pick some fruits for der kon meet us. Dem sey, ‘Di land wey awa Oga God don give us, good well-well.’ ”
Israel Pipol Disobey God
26Una nor ready to go, instead una kon dey tok against di Oga awa God kommand. 27Una dey komplain for korna sey, “Na bikos God hate us na-im make am take us komot Egypt, so dat Amor pipol go distroy us! 28Na wetin go happen to us? Awa own brodas don make us dey fear, bikos dem sey, ‘Di pipol wey dey di land big well-well pass us; dia kountry dey big and dem fence am rish heaven. Wi still si Anak shidren-shidren for der too.’ ”
29So I ansa una sey, “Make una nor fear dem at-all! 30Di Oga una God go first go fight for una, just as una si evritin wey E do for Egypt 31and for di wildaness where E for karry us like man wey dey karry en pikin. Na like dis E dey do for evriwhere wey una go until una rish dis place.”
32But even afta evritin wey E do, una nor gri trust di Oga wey bi una God, 33di Pesin wey dey always go find betta place for una, even before una rish der. E dey appear to una thru fire for nite and inside kloud for day time, so dat E go show una di way wey una go-go.
Judgement For Kadesh Barnea
34Wen God hear as una dey komplain, E vex well-well kon swear sey: 35“Nobody for dis una wiked generashon nor go si or enter di good land wey I promise una grand-grand papa dem! 36Di only pesin wey I go allow na Kaleb, Jefunneh pikin wey follow di odas go shek di land and na wetin God wont make e do, na-im e do. I go give en and en shidren-shidren some part for di land wey e bin go look.”
37And God sef still vex for mi, bikos of una. E tell mi sey, “Even yu, Moses nor go enter di land wey I promise una! 38But na Nun pikin Joshua wey dey assist yu go enter. So make Yu enkourage am, bikos na en go lead Israel pipol enter di land. 39Una shidren wey una feel sey go die for road, di ones wey nor know good from bad, na dem I go give di land to. I go give dem di land and e go bi dia own forever. 40But una go turn back go di wildaness towards di Red Sea.”
Kanaan War
41Den una ansa mi, “Wi don really sin against God. Naw, wi dey ready to fight doz pipol, just as awa Oga God don kommand.” So each of una wear una war klot kon ready to go fight.
42But God tell mi, “Make yu tell di pipol sey, ‘Make una nor go fight, bikos I nor go dey with una and una enemies go kill una well-well.’ ”
43I tell una, but una nor gri listin. Instead una go against God kommand kon go fight. 44Amor pipol wey dey stay dat aria kom fight and porshu una, just as wiked bee dey do and dem kill una from Seir go rish Hormah. 45Den wen una kom back, una kom dey kry for God present, but God nor listin to una at-all. 46Bikos of dis, una kon stay for Kadesh tey well-well.
Currently Selected:
Deutronomi 1: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee