YouVersion Logo
Search Icon

2 Korintians 4

4
Paul Dey Bear
1So as wi get dis ministry, just as God don show us mesi, awa hope don strong well-well. 2But wi don stop to dey do wiked tins wey pipol dey hide dey do; wi nor dey do wayo or lie join God word, but with trut wey evribody fit si, wi dey make evribody know for dia mind sey, wetin wi dey do, dey good for God eye. 3But even if dem use klot take kover di gospel wey wi dey prish, doz wey don lost, na only dem nor go si am, 4bikos doz wey nor bilive, di gods for dis time don blind dia mind, so dem nor go si lite wey dey dis gospel wey get glory and dis gospel na Christ wey bi God image. 5Wi nor dey tok about awasef, but wi dey prish sey, na Jesus Christ bi Oga God and wi bi una slave, bikos of am. 6Bikos God wey sey, “Make lite shine from darkness,” Na-im dey shine inside awa heart, so dat E go give us di lite wey show us en glory wey dey Christ face.
Glory Wey Get Pawa
7But dis betta tin wey God give us, wi dey karry am for inside awa body wey go die like klay pot wey break and na God give us di pawa. 8Wi dey face wahala for difren korna, but awa body nor skata; wi dey konfuse sometaim, but wi nor dey luz hope, 9pipol dey ponish us, but God nor let us die; dem dey nak us for groun, but dem nor fit distroy us. 10As wi dey waka, wi karry Christ deat for awa body, so dat pipol go si Jesus life for awa body too. 11Dem always dey won kill wi wey dey alive bikos of Jesus Christ, so dat dem go si Jesus life for awa ordinary body. 12Bikos of dis, deat dey work inside us, but life dey work inside una. 13But as e bi sey wi get di same spirit wey dey give faith, just as dem rite sey, “I bilive; naim make mi dey tok.” So wisef bilive, naim make us dey tok too. 14Wi do like dis, bikos wi know sey di Pesin wey raiz-up Jesus, go still raiz us up with Jesus and E go take wi and una enter en kingdom. 15All dis tins na for una good, so dat God grace wey dey rish many pipol evriday, go make pipol dey tank God more-more and all di glory go bi en own. 16So, make wi nor luz hope, bikos even if awa body dey die go small-small, di Pesin wey dey inside us, dey fresh evriday. 17Bikos di small trobol wey wi dey face naw, go bring glory wey big well-well, wey go last forever and wey betta pass anytin for dis world. 18Wi nor dey look for wetin eye fit si, but na wetin eye nor fit si. Bikos wetin eye fit si nor go last, but di tins wey eye nor fit si, dey last forever.

Currently Selected:

2 Korintians 4: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in

YouVersion uses cookies to personalize your experience. By using our website, you accept our use of cookies as described in our Privacy Policy