YouVersion Logo
Search Icon

2 Korintians 3

3
Leta Wey Dey Alive
1Wi don dey boast about awasef again? Wi nor nid una to rite sey, wi dey good, even doh odas dey wont am like dat! 2Na una bi di leta wey Christ rite for awa heart, wey evribody know and dey read. 3E klear sey na Christ rite dis leta by ensef kon send am thru us. Nor bi biro dem take rite am, but na di God wey dey alive Spirit dem take rite am, nor bi for paper, but na for awa heart.
4Wi get dis kind mind for God, bikos of Jesus Christ. 5Wi nor dey sey wi go fit do all dis tins by awasef, but na God give us di pawa wey wi take do dem. 6Na God make us fit do dem, so dat wi go serve di new kovenant; dis nor bi di law wey dem rite, but na di one wey koncern God Spirit, bikos di law wey dem rite dey bring deat, but di Spirit dey give life.
Di Spirit Work
7Di ministry wey dem rite for slate bring deat kom and di glory wey follow am, nor let Israel pipol fit look Moses face. If di glory wey dey Moses face, fade bikos e dey under di law, 8den how di Spirit ministry wey get glory, go kon bi, since e nor dey fade? 9Bikos if glory dey for di law wey make God kondemn pipol, den di Spirit glory wey dey give life, na how E go betta rish? 10Wetin get glory naw, nor get glory again, bikos di glory wey di Spirit wey dey kom afta am get, big well-well. 11If Moses face get glory, den how di glory wey dey di Pesin face wey nor dey die, go bi? 12Na dis hope wi get and naim dey make us tok without fear. 13Wi nor bi like Moses wey take klot kover en face, so dat Israel pipol nor go si di glory wey go fade komot. 14But dia mind dey klose. And till today, dia mind still block wen dem dey read di old kovenant. Dem neva remove am, bikos na for only Christ body, dem go fit take remove am. 15So till today, anytime wey dem read wetin Moses rite, sometin dey kover dia mind, 16but wen pesin turn kom meet God, dat tin go komot from en life. 17Na God bi di Spirit and anywhere en Spirit dey, pipol go dey free. 18All of us wey don bilive Christ, God glory dey show for awa face. So di Spirit dey help us shange, so dat wi go bi like Christ.

Currently Selected:

2 Korintians 3: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in

YouVersion uses cookies to personalize your experience. By using our website, you accept our use of cookies as described in our Privacy Policy