YouVersion Logo
Search Icon

2 Korintians 1

1
I Salot
1Paul, wey bi Jesus Christ apostle, bikos na so God wont am, naim and Timoti awa broda, rite dis leta go give God pipol for di church wey dey Korint and to all di good brodas for Akaia. 2Make God awa Papa and Oga God Jesus Christ give una grace and peace.
Tank God For En Konfort
3Make wi tank God wey bi awa Oga God Jesus Christ Papa, di God wey dey give mesi and konfort, 4E dey help us wen wi dey trobol, so dat wi go fit help odas thru di help wey E help us. 5Just as wi sofa with Christ, na so too wi go get help from God thru Christ. 6If wi sofa, na for una good and salvashon; if wi dey okay, den una go fit bear di kind sofa wey wi bear. 7So, wi get hope about una, bikos wi know sey as una dey follow us sofa, na so una go still follow us get konfort. 8My brodas and sistas, wi wont make una know about di wahala wey wi face for Asia aria. Di trobol wey wi face, heavy well-well and life kon taya us. 9True-true, wi tink sey wi go die. But dis happen so dat wi nor go just trust awasef, but wi go trust God wey dey wake pipol from deat. 10E save us from deat and E go diliver us. Wi don put awa hope for en hand sey E go diliver us again. 11As una don join dey pray for us, na so too God go ansa all di many prayers wey una dey pray for us, den E go bless us and many pipol go kon tank am, bikos of wetin E dey do for us.
Paul Shange Plan
12Wi dey happy, bikos wi know sey di way wi dey live awa life for dis world and how wi dey bihave with una, dey show sey na God send us thru en pawa, nor bi human being own. 13Bikos evritin wey I rite, na wetin una go fit read and undastand. But I hope sey una go undastand am well, 14just as una don undastand us rish and na wi make una dey proud and na una go make us proud too, for di day wey Jesus go kom. 15Na with dis mind I bi won take kom meet una before, so dat wi go bless una again. 16Bikos I plan to visit una wen I dey go Masidonia and wen I dey kom back, so dat una go help mi wen I dey travel go Judea. 17So, wen I dey plan dis tins, I nor tink before I do am? Wen I dey plan, I dey plan bikos of wetin I wont? Or na bikos I ready to sey, “Yes, yes” or “No, no” at wons? 18But as God dey faithful, wetin wi dey prish give una nor bi make e for bi just “Yes” or “No.” 19Bikos God Pikin, Jesus Christ, di One wey mi, Silas and Timoti dey prish give una, nor bi “Yes” and “No.” But from biginnin, na Jesus bi God “Yes.” 20And evritin wey God promise us, na “Yes” thru Jesus Christ. Dat na why awa “Amen” thru Jesus Christ dey give God glory. 21Na God make wi and una dey sure sey wi dey inside Christ. Na God choose us from odas 22and E don mark us as en own kon put en Spirit for awa heart, so dat wi go dey sure of all di oda tins wey E sey E go give us.
Wetin Make Paul Shange En Visit
23Na God bi my witness, bikos E know my heart! Na bikos I nor won disturb una naim make mi nor go Korint again. 24Wi nor dey try to force una to bilive us; wi know sey una faith strong well-well. But wi dey work with una so dat una go dey happy well-well.

Currently Selected:

2 Korintians 1: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in

YouVersion uses cookies to personalize your experience. By using our website, you accept our use of cookies as described in our Privacy Policy