YouVersion Logo
Search Icon

1 Samuel 3

3
God Koll Samuel
1Samuel kontinue to serve God under Eli di priest and for dat time, God nor dey too give dem message or vishon.
2One nite, Eli wey nor dey si well-well again dey sleep for en room 3and Samuel dey sleep for where di Kovenant Box dey. Before day break as di lamp still dey on 4God kon koll Samuel and e ansa, “Na mi bi dis!” 5Den e run go meet Eli kon sey, “Si mi here, yu bin dey koll mi.”
But Eli sey, “I nor koll yu. Make yu go back go sleep.”
6Den God koll again, “Samuel!” So Samuel get up kon go meet Eli sey, “Si mi here, yu dey koll mi.”
But Eli ansa, “I nor koll yu my pikin. Make yu go back go sleep.”
7Naw Samuel neva still know God; e neva know wen God dey tok.
8Den God koll Samuel for di third time. E get up go meet Eli sey, “Si mi here, yu bin dey koll mi.”
Eli kon know sey na God dey koll di boy. 9So e kon tell Samuel, “Go back go sleep. Wen yu hear di vois koll yu again, make yu sey, ‘Oga, tok to mi, yor savant dey listin.’ ” So Samuel kon go back go sleep.
10Den God kom near and koll am as before, “Samuel! Samuel!”
So Samuel ansa, “Tok to mi, yor savant dey listin!”
11God tell Samuel, “Look! I won do sometin for Israel; wen anybody hear am, en two ear go dey shine like star. 12For dat day, I go ponish Eli family as I don tell am before and evritin wey I tok from biginnin go rish end, go happen! 13Make yu tell am sey, I won judge en family forever, bikos of di sins wey en ensef know about. Bikos en boys shidren dey curse God and e nor stop dem. 14So, I don swear for Eli house sey, ‘Dem nor go fit use sakrifice or korn ofrin take forgive di sin wey Eli family kommit.’ ”
15So Samuel sleep until day break. Den e open di door for God house. But Samuel dey fear to tell Eli di vishon. 16Eli koll Samuel kon sey, “Samuel my pikin!”
Samuel ansa, “Si mi here.”
17Eli ask am, “Na wetin God tell yu? Nor hide am from mi, if not God go ponish yu well-well!” 18So Samuel tell Eli evritin. E nor hide anytin from am. Eli kon sey, “Make God do wetin E like.”
19Samuel kon dey grow and God dey with am. Anytin wey e tok, must happen. 20Evribody for Israel from Dan go rish Beersheba know sey Samuel na real profet from God. 21God kon dey show ensef for Shiloh, di place wey e for appear to Samuel kon tok to am. And wen Samuel tok, evribody for Israel dey listin to am.

Currently Selected:

1 Samuel 3: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in

YouVersion uses cookies to personalize your experience. By using our website, you accept our use of cookies as described in our Privacy Policy