So e kon tell Samuel, “Go back go sleep. Wen yu hear di vois koll yu again, make yu sey, ‘Oga, tok to mi, yor savant dey listin.’ ” So Samuel kon go back go sleep.
Den God kom near and koll am as before, “Samuel! Samuel!”
So Samuel ansa, “Tok to mi, yor savant dey listin!”