I tell una true word, na for una own good naim make mi won go, bikos if I nor go, di Pesin wey go help una nor go kom, but if I go, I go send am kom meet una. Wen e kom, e go show pipol for dis world wetin sin, God raitiousness and God judgement, bi.