Logo ng YouVersion
Hanapin ang Icon

Jenesis 4

4
Kain And Abel
1Adam sleep with Eve en wife and e get belle kon born boy, den e sey, “I don get boy just as di Oga God wont!” So e koll am, “Kain.” 2Eve get belle again kon born anoda boy and en name na Abel. Abel dey kare for di animals, while Kain na farmer.
3Afta sometaim, Kain kon bring some fruit from di groun wey e won offa give Oga God. 4While Abel bring some of di first-born for en animals wey fat pass. God like wetin Abel bring, 5but E nor like Kain and en ofrin. So Kain kon dey vex and e face kon shange.
6Den Oga God ask Kain, Wetin make yu dey vex and why yor face shange? 7“Nor bi true sey if yu do wetin dey write, body go sweet yu? But if yu nor do wetin dey write, dat mean sey sin dey knock for yor door, bikos e won rule yu, but make yu nor allow am.”
8Kain kon tell en broda Abel sey, “Make wi go di field.” As dem dey di field, Kain rush en broda Abel kon kill-am.
9Den Oga God ask Kain, “Where yor broda dey?” Kain ansa, “I nor know! Na mi dey keep my broda?” 10But di Oga God sey, “Wetin yu don do so? Yor broda blood dey kry from groun kon meet mi! 11So naw, I go drive yu komot from di groun where yu for kill yor broda; di groun wey swallow yor broda blood from yor hand. 12Wen ever yu try to plant seed for di groun, e nor go grow well for yu. Yu go dey waka anyhow for dis eart without house.”
13Den Kain tell di Oga God, “Abeg! My ponishment too big for mi! 14Si! Yu dey porshu mi from di land and I must hide make Yu nor si mi. I go dey waka without house for dis eart; so anybody wey si mi, go kill mi.”
15But di Oga God kon sey, “Okay, if anybody kill Kain, seven pesin go die too from en family.” Den di Oga God kon put one special mark for en head, so dat anybody wey si am, nor go kill-am. 16So Kain komot from di Oga God front kon go stay Nod land wey dey di east side for Eden.
As Life Take Start
17Kain sleep with en wife and e get belle kon born boy wey e koll Enoch. Kain build one town kon name am, Enoch wey bi en pikin name.
18Enoch kon born Irad
and na Irad bi Mehujael papa.
Mehujael born Metushael
and na Metushael bi Lamek papa.
19Lamek marry two wife; di first one name na Adah and di sekond one na Zillah. 20Adah kon born Jabal and e dey among doz wey first stay inside tent and get animals. 21En broda name na Jubal and e dey among doz wey first play di harp and flute. 22Naw, Zillah still born Tubal-Kain wey dey melt iron, make difren tools: swod, knife both from bronze and iron. Tubal-Kain sista name na Naamah.
23Lamek kon tell en wifes:
“Adah and Zillah! Make una listin to mi!
Una wey bi Lamek wife, make una hear wetin I won tok!
I don kill pesin, bikos e wound mi;
I kill di yong man, bikos e make mi vex.
24If seven pipol go die bikos dem kill Kain,
den seventy-seven pipol go die for Lamek.”
Seth And Enosh
25Adam sleep with en wife again and e get belle kon born boy, den Eve koll am Seth, bikos e sey, “God don give mi anoda pikin wey go take Abel place. Abel wey Kain kill.” 26Seth too kon born boy and en name na Enosh. From dat time, pipol kon start to woship Oga God.

Kasalukuyang Napili:

Jenesis 4: pcm

Haylayt

Ibahagi

Kopyahin

None

Gusto mo bang ma-save ang iyong mga hinaylayt sa lahat ng iyong device? Mag-sign up o mag-sign in

Gumagamit ang YouVersion ng cookies para gawing personal ang iyong karanasan. Sa paggamit sa aming website, tinatanggap mo ang aming paggamit ng cookies gaya ng inilarawan sa aming Patakaran sa Pribasya