Jenesis 34
34
Dinah And Shekem Pipol
1Dinah wey bi Leah dota wey e born for Jakob go visit di wimen for di land. 2Hamor wey kom from Hiv, wen e pikin Shekem wey bi di prince for di land si di girl, e seize am kon sleep and disgrace am. 3Den en mind nor gri komot di girl body again. E love di girl kon dey tok to am well. 4So Shekem tell en papa Hamor sey, “Make yu help mi get dis girl make e bi my wife.”
5Naw Jakob hear sey dem don rape and sleep with Dinah en dota. But en boys pikin dey di field with en animals, so Jakob nor tok until dem kom back. 6So Hamor wey bi Shekem pikin kon meet and tok to Jakob. 7By dis time, Jakob sons don kom back from di field, but as soon as dem hear wetin happen, dem kon dey vex well-well, bikos wetin e do nor good at-all, bikos dis kind tin nor suppose happen for Israel.
8But Hamor beg dem sey, “My pikin soul dey una sista hand. Abeg make una give di girl to am as en wife. 9Make una allow us marry from una. Make una give us una dotas and make una marry awa dotas too. 10Una go dey stay with us and una fit enter dis land wen ever una wont. Make una stay and sell for here kon get propaty for here too.”
11Shekem still tok to Jakob and en sons sey, “Make una forgive mi and anytin wey una ask mi, I go give una. 12Make una ask mi for big bride prize and gifts and I go give una evritin wey una ask for. All I wont na make una give mi una sista as my wife.”
13Jakob sons ansa Shekem and en papa Hamor with wayo, bikos e don disgrace dia sista, Dinah. 14Dem sey, “Wi nor fit do dis tin; wi nor fit give awa sista to pesin wey dem neva sekonsaiz, bikos dat go bi disgrace for us. 15Na only one tin go make us agri with una and dat na if una go gri bi as wi bi and evry man among una go sekonsaiz. 16Den wi go give una awa sista kon take una own too; wi go stay with una and wi go bi one family. 17But if una nor go listin to us and nor gri sekonsaiz, den wi go take awa dota and wi go-go.”
18Dis tin wey dem tok sweet Hamor and en pikin, Shekem. 19So di yong man nor waste time as e go do di tin wey dem tell am, bikos e love Dinah, wey bi Jakob pikin well-well. True-true, na en dem dey honor pass for en papa house. 20So Hamor and en pikin Shekem kom di town gate kon tok to all di men for di town sey, 21“Dis men nor dey look for trobol; make dem stay for awa land kon sell with us, bikos di land big rish for all of us. Make wi marry dia dotas as awa wifes and make wi give dem awa dotas as dia wifes too. 22But na only for one kondishon di men go agri to stay with us as one family and na sey, evry man among us go sekonsaiz as dem sekonsaiz too. 23If wi do wetin dem tok, all dia animals and propaty go bi awa own. Make wi just gri with dem and dem go stay with us.”
24All of dem leave di gate afta dem don listin to Hamor and en pikin Shekem and all di men kon go sekonsaiz, dat is all of dem wey kom di town gate. 25So for di third day, wen all of dem still get sore, two among Jakob sons, Simeon and Levi, Dinah brodas, take swod go fight di town kon kill all di men. 26Dem kill Hamor and en pikin Shekem with di swod, take Dinah komot from Shekem house, den dem kon go. 27Jakob sons kom di town where dem for kill all di men kon pak dia propaty and skata di town, bikos dem don disgrace and rape dia sista. 28Dem take dia animals and all di propaty wey dey di town and di field. 29All dia propaty, dia shidren and dia wifes, dem katch dem kon skata der.
30Den Jakob tell Simeon and Levi sey, “Una don turn mi to dirty wey dey smell to di pipol for dis land, Kanaan pipol and Periz pipol, bikos of di wahala wey una put for my head. My pipol nor plenty and if dem gada demsef kon attack mi, dem go distroy both mi and my family.”
31But dem sey, “So e good as e trit awa sista like ashawo?”
දැනට තෝරාගෙන ඇත:
Jenesis 34: pcm
සළකුණු කරන්න
බෙදාගන්න
පිටපත් කරන්න

ඔබගේ සියලු උපාංග හරහා ඔබගේ සළකුණු කල පද වෙත ප්රවේශ වීමට අවශ්යද? ලියාපදිංචි වී නව ගිණුමක් සාදන්න හෝ ඔබගේ ගිණුමට ඔබගේ ගිණුමට පිවිසෙන්න
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee