Afta sometaim, en oga wife kon dey like am, den di woman tell am, “Make yu kom sleep with mi.” But Josef nor gri and e sey, “Si, bikos of mi, my oga nor even dey borda shek anytin for di house again and e don make mi dey kontrol evritin wey e get. Na mi big pass for dis house and my oga don give mi evritin escept yu, bikos yu bi en wife. So wetin go make mi do dis kind wikedness kon sin against God?”