Jenesis 35

35
Jakob Go Back To Bethel
1Den God tell Jakob, “Make yu go Bethel go stay. Make yu build one altar for God for where E for appear to yu wen yu dey run from Esau yor broda.”
2So Jakob tell en hold family and doz wey dey with am sey, “Make una skata all di oda gods wey dey with una. Make una go wosh unasef kon shange una klot. 3Naw, make wi dey go Bethel. Den I go build altar for God wey dey ansa mi wen I dey trobol and E always dey with mi for anywhere wey I dey go.”
4So dem give Jakob all di oda gods wey dey with dem and di rings wey dey dia ears. Jakob beri dem under one oak tree near Shekem 5and dem kon start dia journey. Di towns wey dey dat aria dey fear God and fear nor gri let dem porshu Jakob and en shidren. 6Jakob and all di pipol wey dey with am kon rish Luz (wey bi Bethel naw) wey dey Kanaan land. 7E build one altar for der kon koll am El Bethel (wey mean God house), bikos na for der God for show ensef to am wen e dey run from en broda.
8(Deborah wey bi Rebekah nurse kon die and dem beri am under di oak tree for Bethel; so dem kon koll di place “Oak wey dem for dey kry.”)
9Afta Jakob kom back from Paddan Aram, God appear to am again kon bless am. 10God tell am, “Yor name na Jakob, but pipol nor go koll yu Jakob again; na Israel dem go dey koll yu.” So, God koll am Israel. 11Den God tell am, “Na mi bi di God wey get pawa. Yu go dey fruitful and yor propaty go plenty! One nashon; even many nashon go kom from yu and kings go dey join yor shidren-shidren! 12Di land wey I give Abraham and Isaak, I go gi-am to yu and yor shidren-shidren.” 13Den God leave am for di place where E for dey tok to am.
14So Jakob arrange some stone for di place where God for tok to am. E kon use drink take do ofrin for God, den e pour oil put. 15Jakob kon koll di place where God for tok to am Bethel.
Rashel Die
16Dem travel from Bethel go Efrat wey far from der small. Rashel kon dey labor and di belle dey pain am well-well. 17Wen di labor don strong well-well, di pesin wey won help am born kon tell am, “Make yu nor fear, bikos na anoda boy yu won born.” 18As Rashel dey breath like who won die, e kon koll di pikin Ben Oni. But Israel koll am Benjamin. 19So Rashel die and dem beri am for di road wey dem dey pass go Efrat (wey bi Betlehem naw). 20Jakob put one mark on-top di grave, so dem dey koll di place Rashel Grave kon rish today. 21Den Israel kontinue en journey kon go stay for Migdal Eder.
Jakob Sons
22As Israel dey for di land, Reuben kon go sleep with Bilhah, en papa girl-friend and Israel kon hear wetin happen. Jakob get twelf sons:
23Di sons wey Leah born na Reuben wey bi Jakob first pikin, Simeon, Levi, Judah, Issakar and Zebulun.
24Di sons wey Rashel born na Josef and Benjamin.
25Di sons wey Bilhah, Rashel savant born na Dan and Naftali.
26Di sons wey Zilpah, Leah savant born na Gad and Asher.
All dis na Jakob sons wey dem born for am for Paddan Aram.
Isaak Die
27So Jakob kom back kon meet en papa Isaak for Mamre, wey dey Kiriat-Arba (wey bi Hebron naw), di place where Abraham and Isaak stay. 28Isaak stay for one hundred and eighty years. 29Den Isaak kon die go join en grand-grand papa dem. E old well-well before e die and e live en life komplete. En sons Esau and Jakob kon go beri am.

נבחרו כעת:

Jenesis 35: pcm

הדגשה

שתף

העתק

None

רוצים לשמור את ההדגשות שלכם בכל המכשירים שלכם? הירשמו או היכנסו