1
John 3:16
Holy Bible Nigerian Pidgin English
“God love di pipol wey dey dis world well-well, so E kon send di only pikin wey E get to us, so dat anybody wey bilive am, nor go die, but e go get life wey nor dey end.
השווה
חקרו John 3:16
2
John 3:17
God nor send en pikin kom kondemn di pipol wey dey inside di world, but make e kom save dem.
חקרו John 3:17
3
John 3:3
Jesus tell am, “Make I tell yu true word, unless dem born pesin di sekond time, e nor go fit si God kingdom.”
חקרו John 3:3
4
John 3:18
Anybody wey bilive am, God nor go kondemn am. But di pesin wey nor bilive am, God don kondemn am already, bikos di pesin nor bilive God Pikin name.
חקרו John 3:18
5
John 3:19
Na dis bi di rizin why God go judge di world, bikos lite don kom inside di world, but pipol like to stay for darkness instead of lite, bikos dem dey do tins wey nor good.
חקרו John 3:19
6
John 3:30
Pipol must know Christ pass as dem know mi.
חקרו John 3:30
7
John 3:20
Yu si, evribody wey dey do bad tins dey hate lite and dem nor go gri kom out for where lite dey, make pipol nor for si di bad tins wey dem dey do.
חקרו John 3:20
8
John 3:36
Pesin wey bilive di only pikin wey God get, go get life wey nor dey end. But pesin wey nor bilive Man Pikin, nor go get life at-all. God go always dey vex with dat kind pesin.”
חקרו John 3:36
9
John 3:14
Yu si, as Moses karry di snake go up wen dem dey inside desert, na so too dem go karry Man Pikin up
חקרו John 3:14
10
John 3:35
God love en pikin well-well and E gi-am pawa to kontrol evritin.
חקרו John 3:35
בית
כתבי הקודש
תוכניות
קטעי וידאו