1
Jenesis 32:28
Holy Bible Nigerian Pidgin English
Den di man sey, “Dem nor go koll yu Jakob again, but from today go, na Israel dem go dey koll yu, bikos yu don fight with God and man and yu don win.”
השווה
חקרו Jenesis 32:28
2
Jenesis 32:26
Den di man sey, “Make yu allow mi dey go, bikos day don dey break.” But Jakob ansa, “I nor go let yu go, unless yu bless mi.”
חקרו Jenesis 32:26
3
Jenesis 32:24
So na only Jakob kon dey. Den en and one man fight till day break.
חקרו Jenesis 32:24
4
Jenesis 32:30
So Jakob koll di place Penuel, kon sey, “I don si God face-to-face and I still dey alive.”
חקרו Jenesis 32:30
5
Jenesis 32:25
Wen di man si sey e nor fit beat Jakob, e kon shift di bone for Jakob lap komot from where e dey.
חקרו Jenesis 32:25
6
Jenesis 32:27
Den di man ask Jakob, “Wetin bi yor name?” Jakob ansa, “My name na Jakob.”
חקרו Jenesis 32:27
7
Jenesis 32:29
Den Jakob ask am, “Abeg make yu tell mi yor name.” But di man sey, “Why yu dey ask for my name?” So e kon bless am.
חקרו Jenesis 32:29
8
Jenesis 32:10
I nor deserve all di good tins and kindness wey Yu don show mi, yor savant, bikos na with only my rod I take cross Jordan River, but naw, I don divide my family and propaty into two.
חקרו Jenesis 32:10
9
Jenesis 32:32
Dat na why till today, Israel pipol nor dey chop di meat wey dey lap, bikos di man tosh Jakob lap.
חקרו Jenesis 32:32
10
Jenesis 32:9
Jakob kon sey, “My papa Abraham and Isaak God, di Oga God wey tell mi sey, ‘Make yu go back to yor kountry and yor family, so dat I go do good for yu,’
חקרו Jenesis 32:9
11
Jenesis 32:11
Abeg, make Yu save mi from Esau my broda; bikos I dey fear sey e fit kom attack mi, my wifes and my shidren.
חקרו Jenesis 32:11
בית
כתבי הקודש
תוכניות
קטעי וידאו