Wen dem don chop finish, Jesus ask Simon Pita, “Simon, John pikin, yu love mi pass all dis tins?”
E ansa, “Yes, Oga God! Yu know sey I love yu.”
Jesus kon tell am, “Make yu feed my sheep.”
Jesus ask am again, “Simon, John pikin, yu really tink sey yu love mi?”
Pita ansa, “Yes, oga! Yu know sey I love yu.”
Jesus kon tell am, “Make yu kare for my sheep.”
Jesus ask am di third time, “Simon, John pikin, yu sure sey yu love mi so?”
Pita kon dey vex, bikos e pain am well-well, as Jesus ask am di same kweshon three times, “Yu sure sey yu love mi so?” Den Pita sey, “Oga God, yu know evritin, yu know sey I really love yu.”
So, Jesus tell am, “Make yu feed my sheep.